E get some kind kasala fo dis Afrika or Naija wey we dey so, wey - TopicsExpress



          

E get some kind kasala fo dis Afrika or Naija wey we dey so, wey be say if you wan burst d tin fo public place lyk fazebuk, e go dey somehow if oyimbo peopl wey dey fo dis fazebuk hear am so e beta make i kukuma use pidgin abi na broken gramma broadcast d tin jare, altho dis kinda grama go mak peopl wey bin dey tink say i b ajebutta 2 knw say na pure kpako pikin dem bin dey deal with Hehehe! Notin do me finali, God go everli ajebubutta me.. Ami! Abeg e get sometin wey al of us con hate no be smal wen we dey young, bt nw wey we don dey mari smal smal, i con dey notice say we dey do am too to our pikin dem and e dey pain me say dis tin no fit stop fo Naija - D tin b say our parentz too train us wit cain abi na koboko; dem dey use d tin anyhw fo person bodi as if pikin and cow na d same tin, even fo our secondari and primari schl_ d teacherz dey use our buttockz dey do band lyk peopl wey dey play band wit stick fo brigade and boyz scout. So i wan ask, na onli wit cain and koboko we fit use train pikin fo dis Naija wey we dey so? The fear of d cain wey my own buttockz receiv wen i dey smal stil dey mak me fear weneva i cee sm1 wit cain, cuz i go runaway tinkin na me d person wan pieces again - E gud mak we continue 2 dey use cain, sticks, pestle, bamboo, koboko etc fo our pikin bodi 2 train dem? Abi una get ani beta remedi wey we go dey aply fo our kidz dan dis inhunan trainin, altho som believ say na hin dey mak us reason and behav wela wela? Baba God noni o - Na One House we stil dey my Naija peopl, Na lyk dis we go dey-dey..?? Chai..!!
Posted on: Wed, 10 Jul 2013 10:45:33 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015