Good day my people.......... I don come today wan con gist una - TopicsExpress



          

Good day my people.......... I don come today wan con gist una another part of ASUN vs FG matter. Una knw say na jst last week FG give ASUN 1week τo resume work or face the consequences & ASUN reply dem say “NOTHIN DEY HAPPEN“. So less than 48hrs too the deadline, which is wednessday december 4th 2013 dis week & luckily na disame week ASUN wan do dem former oga burial ceremony........ Shebi una dey see gobe? Another tori don shele now, the tori βε say uncle jona talk say no βε him give ASUN 1week too resume work ooo, I wonder who talk am...... Shey the person no get name? So now ASUN don warn parents say make una no allow una pikin go skul foя now, bcos gobe go shele ooo..... Τo knw more abt dis story, Jst grab a copy of ASUN vs FG season4..... Or contact me foя details..... NOTE; no piracy ooo or else EFCC go locate ur house.... Lolz
Posted on: Mon, 02 Dec 2013 11:19:16 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015