HOW TO MESS IN PUBLIC & RETAIN UR IMAGE. To mess for public dey - TopicsExpress



          

HOW TO MESS IN PUBLIC & RETAIN UR IMAGE. To mess for public dey sweet but if dem catch u, no be small embarasment o! Just follow dis guidelines & u are on ur way to being a star in this profession. 1. Wen u enter a hall, check d wind direction,if na closed hall wit air condition or fan,beta for. Maximum impact. 2. Make sure say u sidon face the wind direction. ... 3. Make sure say u get enough leg space. 4. Form ajebo by crossing your legs every now &then. 5. U don ready to execute, try hold am until time wey the hall dey noisy incase ur mess na the type wey dey sound like AK47. 6. Now carefuly cross ur leg, right over left. 7. Elevate d right yansh. 8. Release small (sound check) 9. If no sound, allow make the mess flow steady. 10. Allow time 4 proper circulation. NOTE: 1. Make sure say no be u be d first person to complain . 2. Wen pple begin dey shout "Jesus who do dis wan. E no go better for d person wey do dis kind thing," simply ask "why some persons no fit respect demselves 4 public places?na wa o" 3. No shout pass odas if not u go become suspect. 4. Take style disengage from the area, relocate to another zone and repeat d exercise! Trust me,u will go places wit dis profession.
Posted on: Tue, 02 Jul 2013 12:34:00 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015