Hmm! I dey laff pepo wa dey cmplain abat Rat disturbance 4 benin, - TopicsExpress



          

Hmm! I dey laff pepo wa dey cmplain abat Rat disturbance 4 benin, 4 benin rat go c ur pot of fud, dem nor go enta d pot bt dem go eat d one way dey ground, den dust deir yarsh move ahead. Cum uniben, Ekpoma or AAU if u c Rat, rat b iyk Rabbit. na Ekpoma i 4 c rat way get association,dem speak Esan pass indigene. In d mid-nite, dem go just enta ur room hold meeting RAT: IBHA BOKHIAN BHA WENONSEN (meanin una wlcum, una sleep well?) as u dey slip dem dey judge ur matta. RAT: luk am, witch! If i say make i bit am na dem go say i don give student lasa fever again. big head book, u nor kno ani-tin na only indomie,egg,bread wit tea,corn flates nd Golden mourn u kno. U nor wan dey give us heavy fud way go mak us strong bt d wan way dey mak us fat so dat we nor go fit run, GOD punish u...u wan used hungry kill us abi ok na, hey! RAT: P.R.O of association bring e WAEC check d date way e write exam, chop d subject wa e 4 get B nd leave d one way e 4 get D. RAT: P.R.O also bring e text book, give am d design iyk lucky bday cake. Den we go invite Crocroach mak e cum cheet put as d ice 4 d cake. (text book) Den afta bring d corn flates nd Golden mourn make we drink,abeg check if NAFDAC numba dey. Hey! P.R.O non put too much sugar u kn say e nor gud 4 our bodi. Oboy hey! Dis wan na enjoyment, we don turn AjeeeeeeBooooOOH!
Posted on: Tue, 25 Jun 2013 09:26:18 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015