I NO WAN BE PROFESO AGAIN Since long time before When I be smol - TopicsExpress



          

I NO WAN BE PROFESO AGAIN Since long time before When I be smol pickin I get one big dream for belle I carry am inside my mind My dream na to be profeso . Long time before before I dey like profeso no be smol Profeso know book well well Plenty ideas full him head Wen him pass people dey greet am Wen him talk everybody must to listen That time profeso na like gold For everything wen dem wan do Na profeso dey for front Profeso get respect Dat is why I wan be profeso. Today everything don dabaru For my mama land Profeso no be anything again Gofment no dey respect profeso again How people go take respect am? Dem no dey listen to him advice Him no be anything for their eye. Abeg come see wetin dem dey do profeso for my land E just be like shit Him plenty certificate na like tissue paper Wen him talk dem go say na lie Wen he give advice dem go say him dey craze Ha! I pity profeso o! See all these politicians Wen dem no even go school Some of dem go school smol Their book no reach profeso at all But dem de get plenty plenty money And dem dey open their mouth yakata To insult profeso any how Even sef some of dem Dem certificate na ojoro But as tins come bad for naija Na dem dey comand our profesos Even sef see common councilo Wen be say him no read pass pramari six Him salary dey struggle with profeso. Crazy tins dey hapin for here o! All the sinato for Nija na billionaire E dey collect salary pass Obama Profeso for our land na him poor pass for dis world Chairman for my local gofment dey eat chicken Profeso for my skul dey wak garri Una wan kill profeso? Me I dey vex well -well Wetin dey worry diz people sef? Profeso say make we repair school dem say him dey mad Profeso beg say mek dem put facilities for school Dem say him no reasonable Profeso say give me the smol money wen you dey owe me Gofment say no luxury for poor man and profeso na poor man Help ask gofment ; you wan kill all profeso? Wetin dey vex me pass? The few brothers and sisters wen dey profesor Gofment give dem post Dem betray their felow profeso Dem forget classroom Dem dey stay for big big office Dey ride for big big car See dem dey sleep for big big house Hey! Dem dey eat big big food With big big water for bottle Even sef their drink na big big one Some of dem wey be say dem no get shoe at al Now dem dey wear big big shoe Dem take am march the leg of other profesos Dem forget where dem dey come from Diz one no be betrayal? Me I wan be profeso But I no wan die for hungry For three months now Profeso dey vex, dey cry No body ansa him Profeso no get respect again I no wan be profeso here If you visit our neibos For Ghana, Niger or Benin Profeso na king Dem dey respect him well well I don change my mind I no wan be profeso again!
Posted on: Fri, 27 Sep 2013 07:40:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015