I miss Photostand dats wia poly chics have their RED CARPET, - TopicsExpress



          

I miss Photostand dats wia poly chics have their RED CARPET, showcasing Aba and Ok dress,lol. I miss Guiness spot wia evrybody de fear if d next man na fraternity man lolz. I miss ceremonial ground, wia we go de read 4 night class students go shoot gun nd other students go leave their books wey dem get d next day, jump window nd next 2min hall wey full go empty.. lolz Miss those GingeRin from Engineering students. I miss dat okirika man wey de beside sharon, wia babes buy bend dwn select de form. #smh # I miss Umuerim @nite wia u eat roasted fish, plaintain, akara.Etc. I miss Johnceilia, oboy! Wia guys go carry their chicks cum chop cheap but gud food I miss poly shrine wey dey Umuerim wey U go de come back from school U no go see road pass because dem de road! I miss axe men and baggers fight, lie lie people, 10-0, 20-2, yet we no go even see blood 4ground talk more of 1 deadbody, na 4 sky una de kill dem? lolz I miss STATE people, wey de always carry charger waka up nd dwn inside school. I miss south africa, wia if U de pass U go don comot ur sim card from ur phone, put am for socks,hold d phone 4hand. I mis uzo- mmiri wia guys nd thier chicks cant cum out at nite weda nepa de or not.I miss 1000 capacity hall where if we de write exam we de sit 2 per desk and no turning of neck (Reserve my comment). I remember popcorn stand, wey if U cum late,U go use ur hand hold waterproof,make dem serve U popcorn. Kiaaa!, i no 4get ishage ri i gwa (big fufu nd 2 big meat, choi!!). I miss fidelity and Access ATM wia guys go de queue de check chicks wey fine nd get shape nd d ones wey no fine,nd Ill not also 4get hostel A wia chicks de hang 4 hostels balcony dey check guys wey enta wth latest car nd well loaded... I miss school road 4 winter suite wia guys nd sum chicks de cum club, guys go pass chicks... if i continue i no go finish! Make i end am here jooor......i miss fedponek lyk madddd joooorrr! Continue d fun if U reprsnt federal polytechnic nekede.All thnks 2 ASUP & FG
Posted on: Wed, 30 Oct 2013 05:09:09 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015