IN NIGERIA: Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading - TopicsExpress



          

IN NIGERIA: Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200 MTN Recharge Card Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big ship Then Airtel go come follow say, recharge N100 and win Benin Republic Glo, go just kuku say... recharge N500 and win Nigeria bcos their colour na green Na only for Nigeria you go see fish inside MEATPIE =)) Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines! Na only for Nigeria PHCN dey say: win a brand new GENERATOR if you pay your light bill on time! Na only for Nigeria people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, recharge card, Chin chin, Puff puff, Ogogoro and beer! =)) Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world... Trust me! Abeg na joke I dey joke, no take am personal o!
Posted on: Wed, 16 Jul 2014 00:01:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015