In WAEC examination, Akpors was asked to complete the - TopicsExpress



          

In WAEC examination, Akpors was asked to complete the following: 1) WAEC : He who fights and run away? AKPORS : E don surrender be dat, na fear catch am 2) WAEC : A rolling stone? AKPORS: No fit just dey roll, na person push am.. 3) WAEC : He who lives in a glass house? AKPORS : Na rich politician ego be... 4) WAEC : A stitch in time? AKPORS : Dey prevent further tear tear... 5) WAEC : Birds of the same feathers AKPORS : Na de same mama born dem... 6) WAEC : One gud turn? AKPORS : Na correct power steering fit do am... 7) WAEC : A bird in hand? AKPORS : Wetin e wan be again? If no be barbeque.... Dem plenty for chicken republic WAEC : Half a loaf is better than? AKPORS : beans and gari, soakings without sugar... 9) WAEC : A journey of a thousand miles? AKPORS : Na de person wahala be dat,na why eno enter car or aeroplane jeje... 10) WAEC : He who laughs last? AKPORS: Get brain problem, make dem examine am bcs na beginning of madness be dat... 11) WAEC : A patient dog? AKPORS : Na hunger go kill am... 12) WAEC : All work and no play? AKPORS : Na bank job be dat bros... 13) WAEC : Once beaten? AKPORS : Na revenge go follow be dat... 14) WAEC : A fool at forty? AKPORS : I never see for Naija, our own dey start at 50...
Posted on: Mon, 23 Sep 2013 04:06:53 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015