Jisos and En Dsicilos kon Comot Judea 1Wen Jisos hear sey di - TopicsExpress



          

Jisos and En Dsicilos kon Comot Judea 1Wen Jisos hear sey di Farisi dem don hear sey En dey baptize and plenty pipol dey follow Am pass di ones wen dey follow Jon. 2 (Nor bi sey Jisos Emsef dey baptize di pipol, but na im discipols na dem dey do so), Jisos Tok Wit di Woman from Samaria 3En kon comot for Judea kon go Galili. 4 For dis waka, E go must pass tru Samaria. 5E kon reach one town for Samaria wey dem dey call Sychar, wey near di land wey Jakob giv en pikin, Joseph. 6Di well wey bi J acob own dey der too. Na im Jisos, bicos E don taya from di waka, e kon sidon near di well. Aftanoon don reach by dat taim. 7Na in one Samarita woman com fesh wota. Jisos kon tel am sey, “I beg giv mi some wota make I drink”. 8By dis tiam En discipols don go inside town go buy food. 9Den di Samaritan woman kon tel Jisos sey, “How yu wey bi Ju, go ask mi woman wey com from Samaria, sey, make I giv yu wota drink”? (Bicos di Jus and di Samaritans nor dey agri at all.) 10Jisos kon ansa am, sey, “ If yu know di gift of God and di persin wey dey ask yu for wota drink’, yu go ask Am and E go giv yu di wota wey dey giv persin life”. 11“Oga”, di woman kon tel Am, “Yu nor get bucket and di well deep well well, wer yu go fit get dis wota of life? 12Yu tinks sey, yu big reach our grand grand papa Jakob wey giv us dis well and E drink from di wota too, with in pikin and in goat and en foul” 13Jisos kon tel am sey, “Anybodi wey drink from dis wota go always dey hungry for wota. 14But any bodi wey go drink from di wota wey I go giv am, nor go hungry of wota again, bicos di wota wey I go giv am, go kon bi like river for inside in belle, wey nor dey dry and di wota go giv am evalasting life.” 15Di woman kon tel Am sey, “Oga, giv mi dis wota, so dat I nor go hungry for wota again and I nor go even com here kon fesh wota again”. 16Jisos kon tel am sey, “Go call yur husband make yu and im com. 17Di woman kon tok sey, “ I nor get husband. Jisos kon tel am, “Yu tok tru wen yu sey I nor get husband”. 18Bicos yu don marri five husbands bifor kpa kpa and di man wey yu dey stay wit now nor bi yur tru husband. Na tru yu tok”. 19Di woman kon tel Am, “Oga I si sey yu bi profet wey dey tok wetin go hapun”. 20Our papa dem serve God for dis mountain but una kon tok sey, di place wey pipol mut worship God, na Jerusalem e dey.” 21Jisos kon tel am sey, “Biliv mi, woman, di taim dey com, wen i nor go bi for dis mountain or for Jerusalem wer una go dey worship God. 22Una dey serve wetin una nor know. We dey serve wetin we know, bicos na di Jus na in God first call to Imsef. 23But di taim dey com and e don even reach wen di pipol wey wan really serve God go serve Am for Spirit and for trut, bicos God want dis kind pipol to dey serve Am. 24God na Spirit, and di pipol wey go wan serve Am must serve Am for Spirit and in di tru way”. 25Di woman kon tel Am sey, “ I know sey Messiah (di one wey dem dey call Christ), wey go save everibodi go com. Anitime wen E com, E go tel us everitin”. 26Jisos kon tel am sey, “ Mi, di one wey dey tok to yu so, Na di Persin.”
Posted on: Sun, 07 Jul 2013 08:51:49 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015