Joke Time!!! Akpors Corrects Some 9ja Proverb Akpors was asked - TopicsExpress



          

Joke Time!!! Akpors Corrects Some 9ja Proverb Akpors was asked to complete the following in an exam: Ques.1;He who fights n runs away? Ans; E don surrender be dat nah, na fear catch am. Ques.2;A rolling stone?... Ans; No fit just dey roll, na person push am. Ques.3;He who lives in a glass house?... Ans; Na rich politician wey em be. Ques.4;A stitch in time?... Ans; Dey prevent further tear. Ques.5;Birds of d same feather?... Ans; Na d same mama born them. Ques.6;One good turn?... Ans; Na correct power steering fit do am.*nerd* Ques.7;A bird in hand?.. Ans; Wetin e wan be again if nor be barbecue. Dem plenty for chicken republic. Ques.8;Half bread is better than?... Ans; Puff puff, buns or garri without sugar. Ques.9;A journey of a thousand miles?... Ans; Na d person wahala be dat nah, Why e no enter car or airplane waka. Ques.10;He who laughs last?... Ans; get brain problem. Make dem examine am because na begining of madness be dat.. Ques.11;A patient dog?... Ans; him no stand well na nd even bone e no go see sef.
Posted on: Thu, 13 Mar 2014 10:42:16 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015