Just laf. I was driving down the street @ Alausa Rd,having jst - TopicsExpress



          

Just laf. I was driving down the street @ Alausa Rd,having jst finished answering a call wen a police man suddenly opened d passenger door,entered & jammed it! As usual he wanted something 4rm me...Den suddenly he saw d big Rottweiler dog-Jackie at d back-seat wt tongue stuck out staring fiercely @ him. POLICEMAN: [Shaking] Ah! u carry dog? ME: [I bone face] Yes i carry dog, dat one na offense? POLICEMAN: [Feeling uncomfortable] Na where una dey cum 4rm? ME: 4rm hospital. POLICEMAN: Ehen! u sick? ME: No, na person wey d dog bite we go greet. POLICEMAN: [Terribly shaken by now] Ehen! bt why d dog dey shake head like dat? ME: Na so im dey do if e wan bite person. POLICEMAN: and d dog know you? ME: Yes nah, no be my dog? POLICEMAN: [Sweating] dis ur door, how u dey open am? ME: how u take enter? POLICEMAN: Abeg! Na since i dey try open am bt e no open. [The dog was now getting impatient and gave a small grunt, its tongue almost touching d policemans left ear POLICEMAN: [Now sliding forward] Oga i take God beg u,open d door for me make i comot, i no go collect anything from u. [I opened the door for him & he jumped out, d last thing i heard him say was. POLICEMAN: God punish u idiot, e no go eva beta 4 u & ur yeye dog, wicked man.......!
Posted on: Sat, 29 Mar 2014 21:33:25 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015