Kingsley: Joke of the week. Conversation Between a Rat and - TopicsExpress



          

Kingsley: Joke of the week. Conversation Between a Rat and Man Rat: (with tiny voice) Hello Man: Hello, Who am I speaking with? Rat: Na Mr. John be dis abi? Man: Yes you are speaking with Mr. John, who is this please? Rat: So you no recognise my voice abi? Na me your Room Mate Man: You say what? Rat: Your Room Mate Rat. I dey your Room now. Man: I beg your pardon? Rat: Which yeye pardon you dey beg. I never chop since yesterday wey you waka comot. I check that place you dey put food i no see anything. I check kitchen nothing. I even check your Fridge no single food there. E be like say you wan kill me abi? No problem, I just say make I let you know say that your Certificate 4 inside your wardrobe wey dem write UNIVERSITY OF CALABAR, I don eat the 'CALA' comot, Remaining "BAR". Let me see which work you go take UNIVERSITY OF "BAR" get. Have a nice wkend and please keep your certificates safe. Hahaha
Posted on: Sun, 08 Sep 2013 09:48:39 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015