LADIES.......make una open your to ears wide open and hear wetin - TopicsExpress



          

LADIES.......make una open your to ears wide open and hear wetin i wan tell una as e be say una no dey understand english, i go talk am for pigin... NOTE: Na only pidgin make una take respond no be every man wey dey drive car get money. Some of dem be driver, sum na their papa car, sum na their friend car, sum na their neighbor car, sum even steal the car sef. Becareful make them no catch you inside car with armed robber bcos na only man wey get car you wan follow. Marriage no be by force, if man say him no wan do again, make una no threaten to kill am. Like that woman wey chase her bobo with knife enter police yard, now na kirikiri she dey chop meal. You say you no fit follow small boy, Shey you don 4get say dat aristo wey you dey follow today na small boy him sef be yesterday. No dey look down on those bobo wey dey toast you today, you no know wetin dem go be tomorrow. No be every girl wey stand for road be ashewo. If you open leg because you dey expect brazillian hair, blackberry ,gucci bag, prada perf or pocket money after the action you sef be ashewo, try dey take yourself out small, even if na mama put. That way una no go dey order like Oliver Twist wen him carry una commot. dey try spend small for your man, no be say na just to dey collect from am una sabi No think say all boys wey toast you come for marriage. dey wan study you before dey for fit talk of marriage. Man wey dey find wife no go take you serious if you put pancake for you face like drawing board and wear cloth like say the material no reach. Na only boyfriend you fit find with that kin look. If you wan marry, begin dress and act like wife material no be like ashewo for allen....you no need for advertise your body...belive me the man dem know how it be...you sef dey try buy small small thing for your man even if na small body spray. Shame no dey catch You if na just to dey collect from am.... Make you uphold you dignity and no let one raggidy useless bobo come dey talk to you anyhow cos him dey give you chiken change.... You are beautiful, fearfully and wonderfully made in the Image of the Almighty...no sell yourself short jooooor.
Posted on: Fri, 18 Oct 2013 09:59:07 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015