MAKE I FOLLOW OYIBO Eget dis particular restaurant wey i dey chop - TopicsExpress



          

MAKE I FOLLOW OYIBO Eget dis particular restaurant wey i dey chop for wuse. E get one oyibo wey dey always come chop there too. Any time dis oyibo chop finish him go shout"heey!", so i wonder wetin dey make am shout. I decide to chop wetin di oyibo dey always chop so maybe me self go shout too. When i reach d restaurant last week friday i order wetin di man dey chop dem tell me say na chicken and red wine, so i chop am. I surprise say i no shout i even collect xtra plate but i still no shout. Na then i just vex ask 4 my bill. The waiter tell me say one plate of chicken and red wine na #45,000 then d xtra plate na another #90,000 na then i come shout heyyyyyyy! Heyyyyyyy!! Heyyyyyy!!! Heiiiiiiiii... Till i reach house i still dey shout. #dclef4real
Posted on: Wed, 07 Aug 2013 13:37:09 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015