MONDAY 8TH AUCHIPOLY NEWS LIVE UNA HAPPY NEW WEEK - TopicsExpress



          

MONDAY 8TH AUCHIPOLY NEWS LIVE UNA HAPPY NEW WEEK OOOOO......... Report enter our desk yesterday say Madam rector go hold an important meet with the Academic staff concerning d ND admission list wen dem still dey compile............... Report take plane fly come our studio say HND form go expire latest september 16th so make una take note ooooo.............. Another report come yesterday say Accident almost occur for hostel gate as one dangote trailer almost run enter students due to say he lost control wen he dey descend down the hill but we thank God say nothing happen............ We receive report from Business admin department say regular Exam never finish lecturer don begin force students make dem come block he course, we already know dis lecturer and if u no stop to dey force students we go upload ur full name and the names of ur children here ooo........... Auchipoly tafia know say blocking sometimes dey help students but no bo to d extent of forcing dem against their will to come block, if you be lecturer for this school and u no cane ur line well we go deal with u ooooo thank God say no be only madam rector they see this post, special advicer to Edo state governor also dey read am............ Report enter our studio yesterday say fire almost kill students for deliverance lodge last night as na wan student wen dem dey call Mabel nai leave her electric heater on before she go sleep for another room, na so her room burn reach ground before students begin take water off am, we thank God for their lives ooooo................ Report reach us yesterday say them do wan birthday for 2nd bawark and the place make sense but students no too show bcos of security reasons............ We wan thank all the people wen get wahala for the town before as dem don calm the matter down and peace don dey small, we pray make God bless una as una don finally hear the cry of students and change una to be our leaders of tomorrow oooo............ Report reach us yesterday say he get one JuJu man wen dey come collect money from students for campus 1 and 2 gate, abeg make any students no put money for him hand oooooo, also we go report dis issue and very soon una no go see am again so make una no fear............... Report reach us say e get one mass comm lecturer wen dem dey call momoh usmah na only Nd 1 mass Comm girl he dey follow any time u go he office u most see nd1 girls, if u no stop to dey sleep with small girls na ur wife go see this message next ooooo.............. Report reach us from our neighbouring school wen be UNIBEN say direct entry form don come out and na dis month them go take write the exam oooo so who dey interested make he rush go by before he go late oooo.......... Abeg we dey call on the school management to help caution those Army wen una put for ground for both campuses and especially d one wen dey back of campus 1 gate say make dem just face their duties and leave girls alone oooooo becos dem don oppress boys finish na girls dem wan begin use force for now make una talk to dem ooooo............. ADMISSION ADMISSION ADMISSION If you write this year ND Auchipoly post jamb exam we go give una listening ear to all una complain today between the hours of. 10am today for our inbox....... Also if you get any Question to ask regarding the HND exam wen dey come up make u still inbox us ur complain same time........... Na here we go take end our news today if u get info or advert make u let us know we go confirm am before we go post am for you here live.......... AUCHIPOLY/EDO STATE MUST BETTER: NA ME TAFIA THE OTOTA OF AUCHIPOLY D OTARU OF AUCHIPOLY D ONOGIE OF AUCHIPOLY D EAGLE EYE OF AUCHIPOLY Nai dey knack una dis news, abeg make I go supervise exam for campus 1, una bye bye...........
Posted on: Mon, 08 Sep 2014 06:31:46 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015