Malouda don waka go Turkey 19 Jul 2013 06:41:27Andrew Randa France - TopicsExpress



          

Malouda don waka go Turkey 19 Jul 2013 06:41:27Andrew Randa France midfielder Flornt Malouda don port go Turkey fes division club Trabzonspor from Chelsea, de six time champions for Turkey anounse on Thursday. De winga go kollect korrect 2.5 million euros everi seasin afta Chelsea wey dey England Premier League rilis am afta hin bin play for de reserve team las seasin. Malouda wey be 33 yearsplay hin las match for de Londoners wen dem beat Bayern Munich for de 2012 Champions League final, but since dat tim shirt come hard to find for Chelsea afta manajas Roberto Di Matteo and Rafael Benitez wey kollect de work becnh am. De Turkey club wey dey Turkey north east don win six titul for Turkey bitwin 1975 and 1984 and don play Turkey Cup final las seasin before dem come carri numba nine for League. Trabzonspor bin kuku lose de Cup final 1-0 to Fenerbache, come kwalify for Europa Cup for nes seasin.
Posted on: Sat, 20 Jul 2013 08:09:52 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015