Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading - TopicsExpress



          

Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200MTN Recharge Card. Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big ship. Then Airtel go com follow sey, recharge N100 and win Benin Republic. Glo, go just kuku say... Recharge N500 and win Nigeria bcos their colour na Green. Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE" Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. Na only for Nigeria PHCN dey sey:- Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wata pity) Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green. Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer. Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world... Trust me.
Posted on: Sat, 24 Aug 2013 11:45:06 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015