Naija I Dey hail ooo. Niger @ 53 HBD My loved country Na only for - TopicsExpress



          

Naija I Dey hail ooo. Niger @ 53 HBD My loved country Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE" Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. Na only for Nigeria PHCN dey say:- Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill. Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green. Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer. Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world... Trust me. Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical Engineering dey do him NYSC 4 Police station. na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once while his mother dey sale akara and bread for jungle Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work as generator repairer. Na 4 only Naija, you go see madman dey control traffic, people wey their head correct dey obey... Na 4 only Naija, wey you go see the president senior the country herself. Na 4 only Naija, you go see native doctor dey use laptop conected with mtn moderm. Maybe they ar nw consulting the spirits online Na only for naija u go see a man selling a book from street to street dat says HOW TO MAKE MONEY WITHOUT STRESS. I wonder why him no read d book. Na only 4 Naija obituary poster dem go say "MAMA HAS RELOCATED" Naija I Dey hail ooo. Niger @ 53 HBD My loved country
Posted on: Tue, 01 Oct 2013 09:50:10 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015