News @ The Hour. 31/05/2014. Report enter studio thru Church - TopicsExpress



          

News @ The Hour. 31/05/2014. Report enter studio thru Church of God Mission say Local Government respond very well today as dem pack all the dirty wey dey side of Stadium between market. And also close to Sapele Lib. But one Ofolunchu wey still be imbecille don go throway fresh dirty for d place again. Hon. Julius Egbedi you don dey try abi u wan contest chairmanship election. Report pass thru Bethel Baptist Church enter studio say One Uvwie LGA chairmanship candidate wen be PDP e name na Hon Peter Abugewa come declare and take Blessings from Ejele hand 2day for him compound as Tony Tripple Chair a.k.a Bando broda dey busy dey play Snooker 4 d compound. Report fly enter studio thru Methodist Church say Godwin Ebosa carry one person wen e wan come out 4 Governor position come see Hon Diden Ejele 4 e compound, as e be now Ejele don turn who dey decide, d person wen e go win Election for Delta state. Report treck enter studio thru Cherubim and Seraphim roof say d burial of Mrs Asule, wen dem do for crowder wetin mak d drinks for d cooling van no cool b say na dis morning by 11am nai dem tak go pay for d van and na dat same time dem tak carry d drinks put for d van b4 everytin finish na dat kind 12noon. So make unu nor feel bad about the hot drinks. Report enter studio thru Ebeneza Baptist Church as we dey ask d person wen dem give d work to dig those gutters wen dey cementry road as he nor wan go pack d rubbish wen dem bring out,make unu try look d road make unu see waitin I dey talk about. I even talk to one health worker he say nor be dem dey pack d dirty for d place. Hon. Julius Egbedi try visit dis issue. Report waka enter studio like Obeche wey dey GH thru Catholic Church say nor be small work all those Aboki wey dey sell Onions for Palmer Road by Ethiope dey work dis morning as dem observe d sanitation well, naso dem gather dey pack d gutters, naso d gutter dey smell dem nor mind dem just dey jump put dey clear am dey go, d useless Landlord Daughter Ode just dey shout for one of them anyhow like say na she born am, she don dey go 50years she Neva still comot from papa house, she beta change her bad character and her attitude make man for see am bcos she short normally, so physical appearance na zero. Report enter studio thru Anglican Church say Palmer rd before u reach Ogodo rd junction, dat place nai Mega Planet customers don take dey do outdoor charlet now, naso boys and girls go just dey corner for dere for night dey doke like say dem be goat. Make unu dey do tins wen e go dey tell well of dis our Sapele. Report enter studio thru Assemblies Church say nor be small work nai Palm Avenue pipo do today to clean deir environment but the problem wey dem come face na say Local Govt norva still send Truck cum helep remove d dirty wen dem gada put for corner. Report pass thru Jehovah Witness enter studio say Happy Overah do birthday for e small woman yesterday but beer wen e buy nor plenty and e just dey spread like who chop adadamu for hot sun. Make i go rest for Police Station groove dey dere. God bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 31 May 2014 13:13:07 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015