News/Updates @ The Hour 19/10/2014 Today our studio stand - TopicsExpress



          

News/Updates @ The Hour 19/10/2014 Today our studio stand erect to rememba our mentor and inspirator, Dele Giwa (16 March 1947 – 19 October 1986). Late Dele Giwa na Nigeria Journalist, editor and founder of Newswatch magazine. Dem kill am with Letter Bomb for he houx on d 19 October 1986. The assassination happen two days after he face interviewed from State Security Service (SSS) officials. Farewell our hero. Today, our studio don complete 3 Years. We thank unu wey dey enjoy us LIVE and DIRECT. Our studio appreciate all of unu for unu constant followership. We thank unu for unu continious prayer and support. We nor go let unu down. We go kip our pace and we salute unu wey stand wit us during d PabloEbolatic times Enariscrazism period wey FaceBook do us. We don dust dos sickness enta gutter as we flush dem enta akpankpan. Thank You Safirians. Thank You Deltans, Thank You Nigerians. We go do Thanksgiving for all d Church wey dey Sapele very soon as we don map out events and our Annual Award updates. Watch Out. Make unu send us our anniversary gifts. Lolx Report pinto enta our studio say Winners Chapel Crudas Road Branch do their Anointing Service today. Dem tagged am Anointing for Success. Watin Pastor Israel preach today em, if all of us fit dey do as watin the word of God dey say, our lives for nor dey get regrets. Make unu clap hands for today preaching. I still observe late coming sha. Paul Del Rosca, nor deny say u nor come church late. Deacon Andrew wey dey choir, atink na wen Pastor dey preach nai u take dey talk follow church? All dose boys wey dey play instruments for choir, unu don born again or born against? Na wen the word of God dey go on nai unu take dey patrol follow church like say na security unit unu dey. Chuks Omoruyi, I know say u don marry and people don know say u don marry. Abeg nor dey show urself dey waka yagayaga inside church if u dey go chop make people nor dey notice u. Na wen pastor dey preach wey everybody dey pay attention nai u take dey waka-jugbe make dem for notice u. Couple urself. Report still fly enta studio say na 7 Days power packed seminar nai dey shele for Winners Chapel Crudas Road as from 2mrw on Monday to Friday dis week for church. Na me and Pastor Israel Olaniyi nai dey organise the programme. We tagged am:Killing The Goliath of Sweat and Stagnation. Ozigizaga lol. I dey invite all of unu wey need the anointing of God upon unu life bcos na me go dey do the opening prayers. Report enta studio say Army don beef up security around Enehrhen Area for Warri as issues of robbery don dey too ring bell. As we dey update so, na pack and search these Army dem dey do to c say all suspects nor get way to opreate. We dey call on our own Batallion Army for Sapele to borrow leaf from Warri Army. Nor be to dey flog girls and doke dem be unu own. Report jump enta studio say na River Henry Ofa nai gada ontop Okoloko Bridge yestaday as d flood wey gada ontop d bridge disturb motorist well, well. Dat na as a result of d stupid and unproffesional work wey Henry Ofa take tif money all in d name of DESOPADEC. I fear for dat bridge becos I dey see collapse soon. Report fly enta studio say as we dey update so, na two canopies nai mudiaga for New Rd by Owumi Junction as PDP Chairman candidates for d next wik Saturday Election don dey pay visit to all wards. Ejaife Odebala and Jugbale posters juss full d ground as all dem Hon. Goodluck Arimethan and Ojolu PDP faithfuls juss dey smile muen-muen dey wait Omizu Okpuyowina Today we wish BABY DIVINE Happy Birthday. We pour drink for ground as we pray make God make her great among her equals as we use d soap and water of LONG LIFE, PROSPERITY, GOOD HEALTH AND RENTETIVE MEMORY take sponge her body today. Na Yak and Phina nai say make we wish u. Report (Unconfirm) don land our studio say Pastor E. A. Adeboye of Reddem Christian Church of God, go land Sapele dis December. We go kip unu posted. As we dey update so, Overflow Ministry (Promise Kingdom Ministry) don dey cause Mega Gridlock of Sapele as dem tanda dey do their rally of their CONVENTION wey go start 2mrw for their main headquater wey dey Okwokwori for Amukpe. Bishop Godday Okokporo juss sitdown ontop he jeep dey wave pipo as their instrument juss dey cause ear blockade. GOD BLESS SAPELE 3 YEARS NOR BE JOKE OH SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 19 Oct 2014 14:09:48 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015