Noon News/Updates 15/06/2014 Report pass corner of fence - TopicsExpress



          

Noon News/Updates 15/06/2014 Report pass corner of fence enta our studio say today na anointing service for Winners Chapel Crudas Road. Na Deaconess Joy Olajide (Pastor Olajide wife) nai do song ministration. E no easy. She try. Make d church authority talk to those instrumental boys. Na church dem come or na just to play instrument nai carry dem come Church? Make their spiritual life dey uplifted (Obi and co make unu take note). Church attendance few today due to demolition wahala. Even madam Zobo don empty her store. Report use top of roof take land studio all d way from Owerri, Imo State say na 3 bomb nai dem see for Winners Chapel for Owerri dis morning, but we thank God say d bomb nor explode, before dem call anti bomb squad come. So because of that katakata, d first service nor con hold for d church. Dem con hold d service for hero square before concord hotel owerri. But second service dey go on now for inside d church. Praise God. Report enter studio thru mama Emma store 4 Yoruba Rd say na yester nite dem mourn late Solomon Adeleye wey be Carpenter wey die 4 Auchi Rd. Na for Ofortokun Rd dem 4 do d burial and na Pastor Sam nai pray as dem burst wine and prepare Dog Pepper soup wit Palm wine. The burial cum turn serious Party. Any where Solo dey make e Soul rest In Peace. Amen Report use code777 enter studio say na yesterday nai friends of Black Bone gada mourn am to pay deir last respect for am. Men frm Udi, Mikaino, Ethiopia, FJ and frm abroad of Ts nai dominate d ground. Black bone d struggle continues as a fallen hero. Ur frnds say mak u go Lord heaven dey wait til unu go meet again. Courtsey Popo Shalo. We dey call on d Army Captain of Sapele Capt. C. O EYINADE say make he warn all dos he boys say make dem nor dey carry dey chase dos pipo wey dey stand dey look d demolition exercise. Dem chase one old mama break leg yesterday for Boyo Rd by Market Rd Junction. Na beg we dey. Report land studio thru Mama Oghale kitchen say d demolishing team don start deir own environmental cleaning within d affected areas. As we dey report so na 4k be d boy levy and d staff wey follow them cum na 10k daily. Oya make unu pack unu dirty fast, wicked pipo. Lolx We dey call on BEDC to go rescue d pipo of Mission and Ikomi Road for darkness as we norva see lite for 3 Days now. Na dat transformer wey dey d Junction of Ikomi Rd by Mission Rd nai dey serve my grave lite. To avoid spirit slap, make unu go fix our transformer now. Wahala dey Assemblies of God Church Atufe Road branch since last week. The Pastors dem dey fight. We suprise to see policemen full there dis morning wey I dey pass with my hummer Jeepbarrow. Report from Ejele support group. The Mathematics Competition. Na Okpe Grammer school nai win d first position, Obule integrated school nai take second, third place na International School, y d fourth position na St. Loius school. All of dem na from Sapele here. Na the first season of d competition for Sapele Local Govt nai be dis. Dem start am since May 5th to 14th June 2014. The competition na good thing wen other leaders must follow bcos Ejele don show to the world say e love education well well and not only church things. Wit regard to Ejele, we all know him educational background dat time say no educational skill but very just now Ejele dey read, write,speak and dey promote education now. So I no see why other leaders wen go school pass Ejele dat time nor go emulate wetin Ejele don do so. Akpeki, Igbuya, Aye­ mindejor, Ejaife Odebala, Godwin Atose, Joseph Egidba Professor Eferakeya . All dis people na Okpe and na Okpe Grammer school nai win. Unu must support watin Ejele dey do so. The first price take away one laptop and one iPhone each and na 3 people from each of d schools. Second price take away one iPhone and note books each. Third price and fourth price also get thier gifts. Cash wen dem give d skools wen win na 150k,100k,50k, 20k and 15k. See as education good ooooooooooooo Ejele don dey read write and speak. Moreover, d competition na govt school win am. D big names wey grace d quiz many well well, Solomon Abeke, Chief Ekewu from Jesse, the peace ambassador for UNESCO for youth peace dey there, Okireka from Warri, big girls from different places,many govt men wen Ejele be thier leader. Ejele just dey eat pig and kpokpo garri dey read complete sport. We wish all FATHERS and YAWO MEN for dis forum HAPPY FATHERS DAY. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 15 Jun 2014 11:11:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015