P.m/Entertainment News. 13/12/2014. Report enter studio say - TopicsExpress



          

P.m/Entertainment News. 13/12/2014. Report enter studio say na Joy and Justine nai wed and do deir reception for Sapele Athletic Club. The couples try deir best becos the wedding dey successful. Na soso Meetings group nai sidon for all the Canopies. The Bridal Train dem nor too fine and deir gowns be like Mamiwater own. The DJ finish work but na the kind musik wen e dey like nai e just dey play. Them dey look face dey share food and drinks but as a smart guy i kolobi 4 plates of wakis and 6Dubic. The Grooms men nor dey organize at all but wen i dey commot,i just dey bless the couple with my mouth becos i eat well. Report enter studio say them do one kain end of year party for International School wen dey Okpe Road by Amuogodo. The party make brain and na so children just dey happily dey swellow food. Some group of children present drama and some dance. I dey very happy wen about two children come out cum recite poems. The School Teachers dress well and maturedly but their make-ups na die. Na so one Girl wey dey teach draw eyes like Witch Secretary. Na 4 Bottles of Mineral nai i cancel. Report enter studio say na Racheal and Wisdom nai do Wedding for Labelle Event Center today. The Hall nor too full but the decoration na the highest. The Couples nor quick come the reception ground but the DJ represent well. The two M.c nor just know book at all. Dem dey speak bad bad engrish. The people wey share drink almost use soft drinks take faint me for d Table wen i dey. The couples dey very happy and the bride just dey smile becos she don tire for her parents Houx. The cake fine but the designer just dey use grammar dey disturb the cake. The bride family just dey do shakara like say na Moon dem from come. Na 5plates i chew with 7 Can drinks. The couple nor gree enter the Event center wen dem hear Ada Ada Ada becos d musik don too popular. Comrade Benson Okorodudu Papa burial wey dem do for Jesse yestaday tuff like Abacha burial. Our rover camera wey we set from studio capture pipo like Hon. M. O. Igbuya and oda Labour union excos and members of NUEE for d ground. Julius Egbedi and O.J Overah tanda with their wives for d ground. Osiowan Igbuya, Abel Oyawiri, Mrs Okolin Opus Dei, Bar. Effurievwe, Comrade Goodman Omoruyi, Com. Chris Omoneh, Authur Ovwah, Wale Odugun, Amadi, Edwin Ogumu, Perkins Umukoro, Morrison Ikoyo e.t.c, all tanda for d ground. Naso food dey do shagalo dey enta pipo mouth as drinks begin dance kirimomo for pipo throat. MC Synagogue wey be broda to Benson Okorodudu begin host Comedians wit owo soup as Mc Bitter Ice cream just dey smile mue mue like who win naira bet. All d comedians complete including female comedian Roda wey do yam leg like gedu. Different meetings dey d ground as Teguonor wey be Billion sista juss dey dance with her retired big yanch wey men do take do kalo-kalo tire. Abel Oyawiri jus dey spray moni anyhow as he almost wound me wit moni. I vex commot for d ground wey beer odour wan crack my brain. Report enta studio say na daughter of Doctor Otobo wey be Children Doctor nai marry today for PHCN STAFF CLUB Ogorode. Naso d girl fine despite say na her natural hair nai she use. The boy fat sha but he still handsome and naso nai he dey rock steady with e futu futu body. Food surplus. D boy pipo cook cum and naso d girl pipo still cook cum. Na food competition nai we witnex today. Drinks begin do room and palour dey enta pipo throat. All d bridal train girls be lyk pipo wey dem take wash belle. Naso Ufuoma mixed secondary sch teachers tanda for d ground becos d girl mama nai be principal for d sch. I drink 6 create of Amstel malt. Afta d party, drinks wey remain go reach take do 7 girls marriage for d forum. Make I call names? Report use pinch take enta studio say dem do one wedding reception for front of Linkers Mafuru Charlet today. Naso dem use half yard of material take decorate d place. The couples dem try their best for their age. D Rice and meat scarce like fuel for ground. Drinks dey but e nor go round. All d bridal train girls do face like native kpukpuyeke as dem begin collect number from guys hand. Naso men wey come marriage begin to dey go do short time wit okpo for Mafuru Sodom and Gomorah Charlet. I vex commot wey d scent of d rice nor too last for my nose. Report enter studio say na bunch of small children nai tanda yesterday for IDON HOTEL dey club. With the way and manner wey dat NIGHT CLUB dey go,i go soon instruct make dem close down the club becos the people nor wise and the chicken wings wey dem sell yesterday na chicken wen don spoil. Paul Police you go soon tell me which kind club you build wey u nor dey fit sidon manage ur Hotel ursef. Report fly enta studio say Catholic Church wey dey Gana host two wedding receptions today. One for front of d Church and one for back of d church. D one wey dem do for front na Clementina and James. James Oderhohwo na old cargo wey be my smally in dos days. I thank God say he don finally marry. D couple dem try but James family pipo wan use drag take dull d party. Rice begin dance for pipo table and drinks con dey do waving for pipo body. All the men in suit do face like squirrel wey lick lime wey nor ripe. Naso babes wey get big yanch con dey dance weda dem go see who go carry dem go do fabrication. I chop reach 3 plates of rice b4 I commot. Report enter studio say na Chioma and Ugochukwu nai wed today and na for Event Galleria dem for do the wedding. The Hall wey dem use na the Conference Hall. Na so Akpu dey gollow for pipo Tables. Wine dey d ground but e nor plenty. Na so rice dey make noise for the place. DUBIC and GOLDBERG just dey compete for Tables. Na snake gown d bride wear why Ogochukwu Suite fine like old Alinco coat. Na only water dem give me for the reception. Report enta studio say na beta gridlock nai Sapele experience yestaday. Dis na d problem wey we don dey get for d town lately. D hold up start frm Amukpe Yestaday go jam Ajogodo. Naso pipo begin trek. Our studio Navigating Emperor Rolex camera capture Odafe Isaba wey be our friend for dis forum wey dey trek zabu zabu as hold up wan finish am. We dey call on d relevant authorities to go vacaut dos abadoned vehicle frm d road so dat d hold up go easy small. Report jam our studio roof say one idiot wey dem dey call Emma Ugole don dey confess kakara (witch) for Ojolu. Our studio don dey collate all d tape wey dis guy dey confess since as dis Emma Ugole don confess ground full. We go release d full confession wey we don title TRUE KPIANS CONFESSION OF EMMA UGOLE. Stay tuned. Report enter studio say the SUNDAY OGBA Hotel wen dem one officially open dis evening host one wedding reception today. Na so the Musician just dey happy wen e see fine stage. The groom just dey buga like say na him build d Hotel dash Sunday Ogba. The venue make brain for reception but na only 5Plates and 6Wine i use press my belle. Na manage i take commot dere. Report enter studio say big name George Ogaga dodge enter the town and e hide for one side. In those days na U.K Boys and Yankee Boys dey make Xmas dey sweet for Sapele but e b like say Ghana Burgers don take over the show from Uptown people hands. Infact make i ask unu U.K and GHANA BURGERS who hot pass now? MAKE UNU COME THE ENDING OF SHELL ROAD. I DEY WITH TIMAYA AND ORITSHE FEMI FOR G1 HOTEL. SEE GROOVE God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 13 Dec 2014 18:51:43 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015