P.m News/Updates. 09/12/2014. Report enter studio say the - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 09/12/2014. Report enter studio say the motor wen jam person almost die,for Abeke Road opposite Chief Abeke compound and e run. Report enter studio say the motor, dey that Mechanic workshop wen dey near Great Eagle Guest House for New Road befor Shell Road junction yesterday. To all unu wen report the issue come,oya make unu go track d motor dere make unu resolve the issues without quarrel. Report use Jido take enta Studio say Bernard Osakoh wey be broda to Jude agadas run come for Ghana. Wen our studio man around town view d report, we con see am say na beta sickness nai Bernard use take enta Sapele. If to say nor be God and Bernard mama, Bernard for don kpuff. Bernard, weytin u go do for Ghana leave u fine yellow wife wey dem dey call Rebecca? Report enter studio say BARR T.K THOMAS wen i order to handle those two children case and also ask am to defend dem for Court,wey dem put for Remand Home. Court don discharg them today,becos the people get lack of evidence and judicial incapacity of the charges, bcos of the age of the children,according to my small Lawyer,them dismiss the two children case and discharge dem on my Lawyer preliminary objection to the charge. Joel and Endurance don commot from detention immediately. Make unu helep me thank Barr Toju Thomas becos e say if i nor pay am,e go scarter my grave. Report enter studio say PDP Delta North Senatorial Primary Election wey hold for Asaba,say dem don cancel d election, due to grievances from some of the aspirants and their supporters. Nor be small thing as the aspirants hold the electorial officer down say e nor go leave the stadium if he nor continue with the primary election. But he stand he ground say na bcos of the carry do and yagayaga behaviours of the people. Na so he come declare the election inconclusive. Na the second gate nai the electoral officer take manage commot from d ground before all those suffer-head supporters reach there. Report use okwalisor take enta studio say na dis weekend nai MC Dockay go marry he wife wey dem dey cal Ejiro. Unu know how pipo wey nor too get height dey like heavy duty, na dat line nai Mc Dockay still enta. We wish unu success. Mc Dockay, u feel say u go fit code am from me? Report use Otigedeogun Rat take enta studio say one Church wey dey Adeola Rd opposite Ogbimi Upstair. D name of d Church na Gods Rhema Assembly. Dis Pastor don dey collect d money and belongings of d masses wey dey go seek miracle for he hand. Dis guy go say make pipo con sow seed with their phones. He go still instruct pipo say make dem con sow seed with money. If he see woman wey get belle, he go say make d woman go buy pampers dash motherless home and make d woman sow seed of money for d pastor. Naso, so money and property nai dis pastor dey request. We go soon come close down dat ur Church if u nor take care. Report enter studio say the Sapele Chapter of Secondary School Teachers do deir End Of Year Party today for Okotie-Eboh Grammar School today. The Teachers carry better DJ and na so dem dey bend down dey dance konkon Billo n Skelewu with eachother forgetting say dem be Married people. Leleji just dey move Zabuzabu dey follow all the corners. Na almost 7p.m dem use close. Report enter studio say the Association of Automobile Engineers pay deir last Tribute to the family of one Late Technician wey don old and e get workshop near Texaco Filling Station. This man na very good friend to one of the Odebalas and e even benefit one big Jeep from the Odebalas despite say he two children wey dey abroad nor dey reason am. Na today dem do the Service Of Songs and all Automobile Engineers for cars nor open today within the town but some few still hide work. From our studio wey dey Okoloko Bridge water,we don dey observe say Sapele dey get serious Traffic due to some new Cars and increase of Keke wey dey ply our Roads. We dey use dis update dey call on Local Government to enforce Task force to helep remove all the Vehicles wey dem abandon for major streets to helep movement easy. Report enter studio,as our CCTV Camera wey dey one of the International Airport catch Hon. Godwin Ebosa as e dey dodge dey enter U.K to go bring down to Nigeria one of the biggest Vessel for Oil. This Vessel go soon land and we dey use dis update dey beg dis Oga say make e nor forget the poor masses wey dey Sapele and the HSE Pipo wen e promise Work from dis forum. We wish you well. We go share all the photos soon for unu digestion,as soon as dem upload am for Net. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 09 Dec 2014 19:10:01 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015