P.m News/Updates. PHCN say make we tell unu say Amukpe Feeder - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. PHCN say make we tell unu say Amukpe Feeder of 12MVA Transformer make one kind sound of BLAST (Gbwa) last night and d transformer don pack up. We nor go see power supply for Amukpe area and some part of d town wen dis Feeder dey supply until dem repair am. The Engineers wen dey in-charge come from Benin to inspect d fault this afternoon. So, The Business Manager (BM), Engr. Orukpe dey appeal to customers say make unu bear with PHCN. The last gbwa wen we troway for Anitah Ogodi body don let her old by force and She don dey cool from carry do. Na so, so face cap, nai she dey use dey cover face dey waka now. My eye still naked for ur body. All those yeye Boys wen dey Salubi layout for Shell Road opposite Orodje Grammar School, wen dey sitdown for d first two provision stores there, wen unu dey gada. As unu dey intimidate pipo bcos say unu dey one yeye cult, nai make unu go fight one guy steal e warlet wey money of N16,120 and e fone yesterday. But God don mak am see d phone but d money still dey miss. Make unu ready as Army don get unu report. Ebere wen dey sell Electronic for Market Road by Cementary Rd. U and ur Husband know wetin unu dey do, as ur wife dey poke dey waka like who her kponyon dey do Interhouse sport. She dey even dey use ur money dey book hotel for guys to fanfan her kpekus. The first tyme wen i yeye u nai u pack go dey do ur runs for Warri and Benin. Report don reach our Studio wen dey back of General Hospital say na d RITUAL wen u and ur Husband do,say as u dey blow small small Boys, unu dey change deir destiny take dey make money for unu business. Wit ur smelly ampit and bleaching curry, nor let me see you for Hotel again, if not na ur picture u go see for dis page. Timi wen marry dat Twin wen get Saloon for Abeke Rd. Call all ur senior Brodas and Family pipo, make unu carry unu Papa sidon for ground, make unu beg am, make e leave small Girls alone, becos d way and manner e dey go so, make e nor go kpuff on top woman. Na in-beteewn 2 Women i see am dey stroll dis evening for near Oghene Road, and e dey programme one against tomorrow mid-field match btw him and d woman. After e go tell Bawo say e nor get money, if Bawo go rag am. You wen get Authentic Boutique for Otite Rd, e don tale i dey spy u with one eye. Na so so small children u dey throway ur kpekus give. U don turn ur kpekus to Rainoil Filling Station wen any kind car dey drive enter. Respect ursef now, becos i go repackage ur Gbwa if u nor change. I use dis opportunity take drop d first warning giv you wen dey stay Atufe Road and u dey marry one Sailor man. As d Man nor dey quik return from work, na so u dey carry different man dey enter ur Matrimonial room, as dem dey lash u anyhow dere. The last man wen lash u last month, nor zip befor e come out from unu room. Ur Girl pikin don dey emulate dis bad habit wen u inherit from ur family. If u nor stop nai be say na ur name and pix i go upload soon. U dis woman wey dey perch for darkness inside motor near Universal Nursery School wen dey Yoruba Rd for where Wisdom Ethisco stores dey, u dey cum there at times dey cum wait one Igbo Boy wey dem dey call Chidi for dat compound wen Apple Drycleaner store dey, d young Boy of about 19 or 21, dey sell Clothes for market Rd and u dis agalagba woman dey sell Cream for Akintola by Okpe Rd. U know ursef and u dey dis forum, just kip quiet waka pass and go houx carry ur Bible pray for ur sins and make God gree forgive you. One married Woman wey get small boyfriend na Sister Ese wey dey do decorations for events and na also tailor, for cemetary rd and her bizness name na Excitement Balloons she and her husband (Kalil) get Qwanta she con vex pack comot but dat one nor be criteria to dey fornicate about. Ese respect ursef before i go naked u for Sapele finish. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 28 Oct 2013 18:44:51 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015