Police officers no dey look before they enter a car o. I was - TopicsExpress



          

Police officers no dey look before they enter a car o. I was driving down the street when a police stoped my car and imediately opened d door entered and jam it. ... As usual he wanted to colect his normal "roja"money frm me.. Then sudenly he saw a big grown dog at d back of d seat wit tongue stuck out angrily lukin at d police.. The followin conversation was made. ENJOY... Police: (shaking) ha" u carry dog? Me: (i bone my face) yes Police: (feeling uncomfortable) na where una dey come from? Me: from hospital! Police: (feelin uneasy) en hen! U sick? Me: no, na d dog oo. Police: (thinking, i don die today) why d dog com dey shake im head like dat? (lukin bak) Me: ok? Like dat? If d dog wan bite person na so e dey shake head o. Police: and d dog knw u o. Me: yes na, no be me get am? Police: (sweating) dis ur door how they dey open nam self? Me: open it na, abi u no knw as u take enter. Police: abeg! Na since I notice d dog i don dey try Open am. E no open o!
Posted on: Thu, 11 Jul 2013 16:25:54 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015