Psalm 23 in Pidgin!! . . . 1.The lord na mai shepherd,i dey kampe - TopicsExpress



          

Psalm 23 in Pidgin!! . . . 1.The lord na mai shepherd,i dey kampe 2.He make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai body thermacool. 3.He panel beat my soul come spray am white,come dey lead me dey go through express road of righteousness for sake of hin name. 4.Walahi! If i waka pass where arm robber,419,and Juju people borku,come even join Ogboni reach valley of the shadow of death sef,mai body dey inside cloth.Your rod and staff nko? Na so dem dey like backbone dey comfort me. 5.You don prepare banga and starch make i chop.All my enemies dey look lyk Otitigbi. You rob me for head wit Vaseline Intensive Lotion.My cup na Ogunpa river wey come overflow hin bank. 6.True,true,betta life and mercy go gum my back till i quench. And man go tanda for God house,sotey sotey,from Lai lai to lai lai. God Almighty,na you biko.Amin. Paulo
Posted on: Tue, 09 Jul 2013 11:14:23 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015