SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 09/09/2014. DIRECT LABOUR - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 09/09/2014. DIRECT LABOUR AGENCY/GOVERNOR EMMANUEL UDUAGHAN Vs sAPELE PEOPLE. Wetin Sapele do unu PDP,wey make unu dey throway dirty for our body becos say unu dey leave for Upstairs? I don talk am before and i go talk am again,say na Sapele nai suffer pass for PDP hands. Na me the Chief Okpubuluku nai stand dis morning to challenge all unu wey dey top offices for Sapele Politically and most especially Chief Lucky Ayomanor. If God nor bless you with job and appointment unu go say God wicked. Na so u dey waka gate to gate dey beg pipo of Sapele make dem vote you into power when u dey contest House Of Assembly the other time. Though u try prove ursef say u be tipika Sapele pikin as u obtain crowd from different places but when the Political big wings blow pepper enter ur eyes,nai you throway corn wey u dey chop carry Umbrella cover body. God come do am for you as dem nack you Direct Labour Agency Deputy Boss for Delta State and as a matter of fact we all follow you thank God becos e nor easy to cross enter Party like PDP and come get Office,most especially for State Level. Chief Lucky Ayomanor u been start well and you go agree with me say i praise you well well and for one of my Phone conversation with Hon. Monday Igbuya i boldly tell am say na only ur sector DLA nai dey work well,becos wen u really start u fight Pot Holes for Sapele and you also really respond to all the places wey we draw unu attention to. If we use Athletic take judge,we go find out say nor be who start race well nai dey win,na who end well nai dey win. So Chief Lucky Ayomanor u don dey fail and dis na d kind thing wen dey spoil yanch nai u don dey do so. I go use dis update take tell you say when you commence Adeola By New Road repair,i draw ear for you to make sure say u finish the work before rain go start,but today dat route na one of the highest apology wen we get for the Town. As a matter of fact i call you when dem dey repair the Road,say dis Federal Road wey u and the State Government wan cut,if unu nor go do am well,make unu leave am like that,but you nor hear my advice. Dis na the errors wey we don dey observe from the Adeola Road by New Road project; *The drainage wen you and your Apprentice Engineer fix for New Road dey higher than the Road,as Cars must break down before them cross over. Nor be so that road be before and na bad Engineer wey u give nai cos am. *The Drainage wey dey by Adeola Road wey unu do to divert water from one side of the road to the other na rubbish to the highest order. I surprise say Slabs wey you Vice Chairman Of DLA do nai don break finish,even before you complete the Road. I shame for you becos na so unu dey use dey spoil Sapele Okpe name for State level. *The Drainage wey you claim say u don open for the both side of the Adeola Road don block finish and as i dey talk to you now,the water nor dey flow pass again as na pipo stores nai e dey enter. *I put am to you say due to poor method to tackle the project,the drainage wen unu claim say unu don do don dey block with red sand,becos when we shook wood inside i see say na sand i dey shook nor be block. etc How long e go take unu to finish one single project for Sapele? Adeola Road by New Road nor be new Project,na old Road wey lack of maintenance spoil. Wetin be the people of Sapele gain if the old good roads wey dey before unu enter power damage and unu nor fit repair dem,not to talk of say unu ever do New Roads wey go helep the surrounding to make am a better City. I nor wan insult or talk to you Chief Lucky Ayomanor wrongly dis morning becos the last time wen we talk you openly tell me say na lack of fund from the State level nai make you norva fit do any meaningful thing to almost all the Road repair contract wen u carry e.g Ajimele Road,Akpoisi Road and this Adeola Road. Chief Lucky Ayomanor oya use your hand count your teeth this morning make u tell us,the hope wey you leave for ground with this current State of Adeola Road by New Road. Make you nor go let me pencil all the Ayomanors as one becos na dsame direction and track wey you take begin before u decamp enter PDP nai my body dey tell me say your Cousine Engr Elvis Ayomanor wan also start again. Make i assume say Elvis go do well,becos dere is no harm in trying. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. THIS NA ADEOLA ROAD BY NEW ROAD. THIS GOVERNMENT DEY DO US GOOD OR THEM DEY GIVE US MORE PAINS? BECOS BUSINESS HERE DON DEY FAIL AND NA HARDSHIP BE THAT FOR US. WETIN BE UR SOLUTION TO THIS PLACE? God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 09 Sep 2014 06:50:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015