SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 21/10/2014 IF YOU NOR FIT - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 21/10/2014 IF YOU NOR FIT HELP AM, NOR JUDGE AM. Mercy with her hussy dey parlour dey play ludo game. All their three children dey sleep for room. Na so music dey play as dem two dey drink one cold red wine dey eat groud nut join like say dem be boyfriend and girlfriend wey just discover love. Oya, count you 3 and 6 make I count my 2 and 6 Mercy cum start to count with her red seed. 1, 2 3... Nai be curtain wey open. Na so mama Blessing, take burst enter their house. She tie wrapper for waist. Water dey comot from her eyes. Mercy surprise to see her neighbour like that. Nai she just stand up Mama Blessing, wetin happen? Mama Blessing try to clean her eyes, but water just dey fall endlessly as she dey talk Na papa Blessing o. This evening when e close come from work, nai I tell am about Blessing and Ejiro school fees becos dem drive dem come back from school this morning. But befor I know wetin dey happen, nai be slap wey e give me. Even befor I gain balance, e don pack me fall begin beat me like say we get quarrel befor. She cum dey turn around dey cry See all my body Na there Mercy for cum tell her say make she go back to her house say she with her husband go cum talk to papa Blessing. Go back? Papa Blessing say e go kill me if I come e house say na me be the witch wey make road safety seize e motor today wey nor make am fit work #1 come house. Me, I nor dey go o make e nor cum use pepper eye take kill me. Mercy cum tell her say make she nor worry. Make she sidon for outside wait dem say dem dey cum. Mama Blessing agree, nai dey start to go. When Mercy know say she nor go hear her voice, nai be talk wey Mercy start Useless illiterate wey nor know when to tell man something. Man wey go hustle from money till night, e norva rest sef, you don carry school fees matter take face am. E nor beat you reach. I trust my husband, he for break your head. Useless woman. I beg play make I kill that your seed wey wan enter house jare Mercy sidon back for the rug, turn small red wine drink. Her husband cum tell her say but you tell her say we dey come na. Make we go settle dem. Go where? Na so dem dey come settle us? I beg I beg. Every mallam with e own kettle o. Make she nor cum use her reggae spoil my blues. Play jare make I high Her husband cum laff as e carry the ludo cup dey shake. Na true sha, some women nor dey sabi treat men. Make we enjoy our game bo. Dem two continue their ludo game. Like say na the game dey important pass love wey dem wan show their neighbour. Mtchewwwwwwwwwwwwwwwww! As mama Blessing dey cry go back, nai she jam uncle David wey dey teach for the school wey her children dey go. Uncle Dave cum block e babe for their compound. Mama Blessing cum tell am wetin happen after uncle Dave don ask her wetin make her dey cry this night. When she talk finish, uncle Dave cum follow her go meet her husband. Na him cum talk to papa Blessing wey make papa blessing realise e mistake say na the pepper eye of say all the money wey e work today, road safety collect am when e dey come from Jesse market, nai e use take face e wife for house. E realise e mistake and finally e cum beg e wife. Dem two thank uncle Dave that night as uncle Dave dey go e house. Nor be to get big head dem dey use dey get sense. Nor be becos say person dey stay near church nai make am be christian. When day break, as papa blessing dey warm e taxi wey e wan use take go drop e Ejiro and Blessing for school before e go start work, nai be Mercy wey carry her children dey go find bike. Na papa Blessing dey carry her three children go school befor, becos na the same school dem dey go. Becos of the quarrel wey mama Blessing with papa Blessing get for night, Mercy cum feel say, papa Blessing nor go get joy this morning. She nor kuku bother to near am. But she surprise to see mama Blessing and papa Blessing dey laff when mama Blessing carry water give her husband wey e wan turn for the radiator. Na so shame grip her. And she nor gree carry her children near the taxi. Anybody wey dey happy to see us cry, e go shame as we go dey smile. Amen. My pipo, God create us complete o. But God create us in a way that only we nor go fit solve our problems. We need to meet one another for help. If nor be so, pipo for nor dey build bridges. Na walls dem for dey construct. But when we tell some pipo our problems, dem go use am dey judge us. say we nor sabi do this. And we sabi do this. Some go use am laff us. And some go turn our matter to headline for newspaper, topic of bedroom discussion and even agenda for meeting. All becos dem dey envy us since. Becos we nor know the mind of person from e face, we nor go know who not to tell or share our problems with. My pipo, if you get problem, share am with who your heart say make you share am with. Nor fear. God get how e take dey answer us. If that person wey you enter rain go share your problem with nor gree help you, may be, as you dey come from e place, you go jam your helper. And you wey dey turn person problem to matters arising, just to diss the person, laff the person and sometimes blackmail the person, if you nor change, na you know. We are one. Let your love for your neighbour big pass your love for gossip and mockery. If person come meet you for help, and you nor fit help am, nor judge am. Just fall on your knees and pray make God give that person helper. By so, you don play your role. And when e go happen to you too, the same thing nai dem go do. Cos what goes around, comes back around. Na wetin person throway e dey see pick. Who get ear, make e hear. Befor I go, I beg, make unu help me answer this question. Family of 4 children, who get say pass during meetings if the names of the children na A. Money. B. Love. C. Honesty. I dey go buy erbelebor for Igbudu market. Make unu wait. God Bless Sapele. I LOVE SAPELE. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 21 Oct 2014 13:50:41 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015