SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 26/10/2014. PLAY TIME: MAKE - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 26/10/2014. PLAY TIME: MAKE UNU HELP ME That day, I dey blow guy with my red polo ralph t shirt, blue Next jeans, green adidas canvas and white rim ray ban transparent glasses. I hold my hard book note for hand. As I enter the lecture room, I nor know say our Chemistry lecturer dey the hall. Once nai be Rainbow, Rainbow Wey e call me. For acada here, na rainbow be my guys name. Unu know why sha. I carry head go up, na me e dey call. Everybody just turn dey look me. Na so I just dey pump like Jolomi Boyo. Nai I answer Yes Sir! Nai be question wey e ask me. E don ask dem for the class befor but nobody get the answer. Nai be me wey e throw the question for. Rainbow Sample A na Water wey you use fire wood take boil, Sample B na Water wey you use coal take boil, Sample C na Water wey you use gass boil, and Sample D na Water wey you use electric kettle boil. Which of these water Sample go hot pass? And why? When e talk finish, I cum say make e repeat the question. E repeat am. I cum think think think nai I say make e wait. My pipo, na so I take dey outside for here take post the question for unu. Oya, make unu send me answer. I dey wait unu answer for outside. Make unu nor fall my hand I beg. God Bless Sapele. I LOVE SAPELE. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 26 Oct 2014 18:53:01 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015