SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER LAFFING OUR FIRST LADY E dey - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER LAFFING OUR FIRST LADY E dey so painful say, small pikin go see e mama nakedness e go begin dey laff with e 65 teeth. This matter na about the way we dey talk about our first Lady for this Country. Our first lady nai be the mama of this country Nigeria. Na she be the first woman and mother for our country. So, make we get this record straight first. Now, na the way wey our first lady dey express herself nai she go use and we go take am like that. Most of our mothers nor go school. Some wey go school nor go far. And this one make some of dem nor dey fit dey speak oyibo man grammar well. Now, since wey our president enter office, nai dem swear Mrs. Patience Goodluck Jonathan e wife as our first lady. And na because of the love wey our papa get for her nai make am let her remain the first lady unlike many men wey go go marry one small graduate just becos e wife nor sabi blow grammar. Now, since wey she be our first lady, our press men dey only dey bring out the mistakes wey she dey do for public. How many times some of us don share the good deeds wey our first lady dey do? Why we dey make jest of somebody wey old enough to be our mother? Why we dey laff and dishonour our leaders? Even if we nor like the person, we nor go fit respect the office? How many of our parents go fit write their name for book? We wey dey write rubbish about our first lady, na we know English pass Hon. Patrick Obahiagbon or Professor Wole Soyinka? Sense dey this rubbish? We dey fool our President wife befor the world just to get cheap popularity. And Channels Television wey dey spear head this nonsense, I believe say them don dey experience low patronage since the Oga At The Top matter come up. Sapele pipo, make we stop to fool ourselves but act mature like pipo wey dem train well. If you know say you dey among pipo wey dey make mockery of our first lady, kindly remove the post. Wetin you dey gain by doing such foolish thing? Some say na joke. Some say na this and that. If na your mama how you go feel? And the funniest thing be say, insult on our first lady means insult on our president. And insult on our president means insult on our Country. And you wey dey insult your country, where lies your patriotism? Make we think. Respect nor be wetin dem dey buy or sell o. Make we respect ourselves. E dey pain me say notable pipo for this forum dey make jest of our first lady becos of the mistake she dey make in grammar. E nor make us mature. E nor make us good citizens. Wetin bad don bad. Make we nor paint am anyhow to look good. Stop making jest of our first lady. Becos some sapele pipo dey do this rubbish, and e affect me and you since we be part of this country nai make me dey talk put. Oya my pipo, make e nor be like say yam and knife dey my hand. I give unu the knife. Oya talk for this issue. The making fun of our first lady on BBM, Facebook and in blogosphere, e dey good? Yes or No! God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 17 May 2014 13:05:51 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015