SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. (OPEN LETTER TO DELTA STATE - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. (OPEN LETTER TO DELTA STATE GOVERNOR AND NUJ DELTA STATE/SAPELE). Dear Oga Emmanuel Uduaghan how u dey today and how ur office dey go? Nor let ur Senator issue distract u for ur Governorship duties oh. Well i get to write u dis letter becos of the rubbish wen d money wen u give NUJ Delta State Chapter don cos within d State. Some times last year u spend from our money several times,dey sponsor some Delta State Journalist go Abroad go learn Course,but to me all na waste of Cash,becos if dem send Pikin go School,somebody suppose see the outcome of d money wen dem use send d pikin go School. This NUJ wen nack u best Governor na becos of d money wen u dey lavish on dem,nai make dem dey over do anyhow,to d extent say,dem cum forget d Role wen dem suppose dey play for our State development. NUJ suppose be group of body wit Integrity. I don dey read Articles of different Journalist,but i hardly see where Delta State NUJ for challenge Our State Governor on Incompletion of Projects. Dem nor dey even dey write on the improvement of the State for Paper or display meaningful details of our State projects. Enough is Enough. Dear Governor Emmanuel Uduaghan (Executive Governor of Delta State) and Mr. Nobert Chiazor (State Chairman Nigeria Union Of Journalist, Delta State Chapter) We dey notify unu now of how Mr Andrew wen dey head Nigeria Union of Journalist (NUJ) Sapele Chapter, dey use d Chapter dey enrich himself at d detriment of oda members, as he dey sypho d Union money without proper documentation and without say e dey do e work effectively to improve d Union. The said Mr Andy get clique for d union wen he and dem dey wack d money as he dey involve dem for various dirty Jounalism deal wen lead to corruption and as such, he dey rub shit for the profession face,becos we from Sapele get issues wit Half and Uncompleted Sapele Main Market and Half Commission Stadium,but dem just fold deir hands dey watch as na only brown envelop nai concern dem for the Job. Mr Andy take N100,000 bribe from Oga Ejele hand during Senate Electiön for my present and he claim say na interview dem go do, whereas na rag he go rag Ejele. Instead Andy and he clique to dey polling unit dey monitor Election to report to there various Media agency, dem dey do waka-waka from pillar to post dey follow Politician houx. Dem dey after d brown envelope as he claim for one of he comment under my post say FREELANCE JOURNALIST NAI MAKE MONEY PASS. Dis Man Job na to snap snatching Ballot Boxes den e go go show the Culprit Oga to collect money,and after dat e nor go post or publish d Pictures or even write about d issue. That nor be d dignity of d union. D union integrity as d Fourth estate suppose anchor on truth and steadfast. Recently, for d summit wen Oga Uduaghan do for Asaba wen he host Journalist,na N20Million nai Oga drop for d Union,make dem use take do Christmas and Sapele Market dey dere wen e norva finish. Na from d bar nai dis Andy, Jo- Amina and Pastor Timeyin Odudu wen be d Secretary gada chop N350,000 from the N500,000 wen dem share reach Sapele Chapel, as dem present only N150k to d Union say nai Oga Nobert Chiazor share reach Sapele Chapter. What an insult. Warri Chapel get reach 1M. Ughelli Chapel get reach 500k, why he be say na Sapele Chapter go get swear money of 150k? Wen I investigate, I con see am say na d trio of MR ANDY, PASTOR TIMEYIN ODUDU and Old man JO-AMINA nai slash d money for corner as dem delay well, well b4 dem come present d money to d union, which means, dem hide some for pocket. Wen I first make d publication for my news, Pastor Odudu Timeyin come confrot me for inbox say na 150k dem give dem and dem kip 50k for d union up keep and miscelenious (dat na oyibo wen dem take dey tif public money) and dem share 100k within oda Journalist wen be d Union members. Where I for know say he dey lie, na wen he for con dey beg me say make i nor spoil he name, say him na pastor. If dis Pastor Odudu knw say na true nai he dey talk, he for stand for d truth rada dan to dey beg. I knw how I take dey catch unu as dem say clear mind fear no accusation if Pastor Odudu mind clean he for nor beg me to stop my investigation. Oga Andy wen be d Chairman, na Benin he dey stay and u dey run Sapele NUJ affairs as Chairman from Benin. U beta resign ur post and join Benin NUJ, if not na dat ur one, one jeans wen u dey tuck-in ur over- sized acube longsleeve put and dat ur yeye carvans nai I go take drag u go EFCC. Jo- amina own na to dey decieve pipo wit fake Camera and he nor dey report anytin for TV. Odudu, YOU carry church for head but devil build duplex for ur heart. NUJ motive suppose be objectivity wen dem anchor on truth. More details lata. We dey call on d State NUJ to dissolve d excos of Sapele Chapter, so dat dem fit conduct new election for credible pipo to take over. Na truth we stand for and we need Oga Andrew to drop he position as Sapele Chairman of NUJ and make he join Benin own becos na where man dey base nai he dey represent. Oga Uduaghan nor go fit dey Govern Delta State and he go dey reside for Lagos State. He dey happen like dat? Oga Emmanuel how long u wan use take build Sapele Market? How long u wan dey play us,wit all dis unpurposeful Journalist against us? How long u wan dey throway money for deir head,to dey give u credit wen u nor worth,as best Governor,wen nor get better Infastructural projects to back up ur developmental sheet? How long u wan dey do all dis tins? Today i dey draw line wit all dis fake Journalist wen dey after d money,as dem dey bury the truth against our public interest. If breeze blow fowl yanch must open,so i don ready to blow the breeze to expose all unu hiden agenda for d State,until unu go begin do the actual things wen go enhance development and growth for the state. From our studio we Impeach Oga Andy. If u support, hit d like button. (SHUT DOWN OF STUDIO UPLOADING) SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 16 Jan 2014 06:12:46 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015