SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. So our Sapele Political Leaders - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. So our Sapele Political Leaders wan tell me say them nor dey hear wetin Military people dey do for "Waterside" since dey come abi? O.k na today i really know say the Rich nor dey care if Poor Man pikin Die unlawfully. On monday Army go water side go carry all the diesel wen dey there because dem (Army) get order say make dem pack all the Diesel from there. But after them park am finish the boys kor dey one show say dem get violent so Army kor shoot go up to scare dem,but one guy wey dey inside the Boat just fear,wen e see Army nai e jump enter the River,so the Army man cum spray bullets for the water,unknowing say the bullet touch d guy for head, so na that on monday nai the disease float come up, so that one cum provoke the anger of him friends well well, because the guy dey very gentle and e nor dey trouble shoot @ all so. As dem dey vex nai Army just drive come Water side. Dem be 5 wey dey the Hilux so three of them cum go River to go pack Diesel nai the guy wen die so him friends dem cum go attack d two Armies wen dey d Hilux, so those ones dem kor shoot go up, so as the 3 wen dey River hear the gun shoots nai dem come outside too dem cum dey shoot anyhow. Meanwhile as Army dey shoot, the Boys wen die so him frends dem cum go Boyo Road near "1st Bank" dem cum dey go there to go burn Tyres because say na dia friend nai die so,so the mobile Police dem wen dey "1st Bank" cum dey warn d dead guy friends say make dem carry dia Tyres go front because dem fit use dat opportunity take Rob d Bank but because say "Apu" know the police guy as person wen dey come rag for ogwanja e nor respect am e cum dey tell am say e fit collect him gun, say nothing go happen so d o other guys cum dey gather heart na from there d police man take vex collect him gun nai e shoot am for chest. But d guy don go thru medical now, so e don even dey work now self. *My people first make we nor reason dis matter with Bias mind. How unu see dis matter? Who dey at fault? As for our studio,we dey vex for the "Army" wey shoot water wen dem know say the person wey jump enter Water dey "Armless". Then why e be say na wen the Boys nor see Money drop nai dem go begin pack deir products, wen e be say the Boys dey settle dem since and 2 Ears nor dey hear that one since. Also we nor find am funny say the angry friends carry deir Tyre go near Bank go display deir anger. Why dem nor carry the Dead body go show who bring dem cum for Secretariat? Infact some times na we dey invite problem for ourselves,and e go good if we go fit stay peacefully avoid Army wahala. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 30 Aug 2013 05:44:18 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015