Somewhere near my house this afternun, i just dey see one of my - TopicsExpress



          

Somewhere near my house this afternun, i just dey see one of my Guy off to the bus stop when i see one clean beautiful girl come out from her SUV dey cry, dey kneel down, dey beg one slim bobo wen be like say him never chop for months,the babe just dey beg dey cry dey follow the guy dey tell am say she no need money, she no need brazilian wigs, she no want shoes, house or anything, she say she no even need the SUV, say she go give the guy anything wey him want. All she wants was his love, his kisses and his warm embrace, the babe just dey shout dey cry, when i heard those words my heart stop o, my head spark and my brain burst, the guy no even dey look the babe sef na then me i vex say if this guy no knw d value this girl then me i don fall in love be that so make I go claim this girl. but as i near there, one man just touch me for back say oboy abeg no block the camera..Rubbish! na even NOLLYWOOD film dem dey shoot ......mchewwww!
Posted on: Wed, 29 Oct 2014 14:56:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015