Sunday Noon News/Updates From d Olu Of Warri throne we join - TopicsExpress



          

Sunday Noon News/Updates From d Olu Of Warri throne we join hands with Winor Kelvin as e kneel down 4 hot sun dey beg Triple Chair for e performance btw him and Triple Chair on Friday. BOYI i knw say ur white hair na wisdom,so 4give Winor na Apiankoko nai use am. (Winor oya say sori). See as u black. Na two workers frm Asaba Airport nai marry 4 Peemos yesterday. Na so tins 2 chop many like sara. The drinks dey cent fuel,d bribe gown be like Mamiwater dress. The Groom just dey dance like plane wey wan take off. If nor be Hon. Austine i for throway d cake bcos d food wey dem give me na Imekpe dem put. Report jump enter our studio say one boy wit green cap just dey disturb Uduaghan park dis morning bkos of Ticket issues. Na so one female Delsu student queens english take baff d guy wit endless insult. Na me settle d dispute wit mouth odour. ARMY 4 Shell Rd. Na both small and big Vehicle dem dey collect money from now. And any Vehicle driver wen refuse to giv money, dem go use the driver do flog jump. Make unu take unu time. Pastor Palmer of Assemblies of God Church wen dey Owumi Rd, ready wait me dis evening as I dey cook ur gbwa with canphor and diesel. As dis rain fall for some part of Sapele dis Afternoon so, he show say God put hand for d marriage of One of Sapele Oldest Manchelor, EDWIN OGHUMU a.k.a Ojolu Landlord. Report do pipi-ogelewa enter our studio say dis Edwin dey do e marriage now for Arahgba. My Cctv dey there now. We thank God for Edwin Oghumu as he nor behave like Peter Tagbajumi wen woman hide go marry for Warri. Dis afternoon nai police use their van take stop one yahoo boy wen dem dey call Onakoyibo Cosmos for Abeke Rd by Mission Rd Junction. D boy dey para dey follow dem say he new Red Toyota Spider get all papers why d police go stop am? I run leave dem. Apiam, we dey call on u to caution Joba. He don dey use d Oguan ja Forum take dey go stop work for d new DSTV site wen dey Urhobo Rd as he dey claim say na Ejele and Atseyinku nai give am d right to take go request for Community Deve. We dey ask now, na which community deve? D DSTV pipo don pay to d host community wen be Sapele-Okpe, why unu dey go disturb dem again? Make unu nor go do wetin go instigate war between us for dis peaceful Sapele wen we don dey enjoy co-existence since time immemorial. Joba, mind ur boundary and make unu Forum (Ogunaja kiniko) give respect to d Land owners. Apiam, call am to order becos na ur hand he wan fall so. I knw say u be person wen dey educate pass dat Joba. Tell am to use he sense. Today we use Ayagha of Good Health take stamp d face of Ena Ofugara TB. As we send d thunder of Long Life and Prosperity take blast am fall today wen be he birthday. Ena Ofugara na my far smally and him na one of d best writers wen I don come in contact with for Facebook but him na fanatik of GEJ as e dey find favour. Lolx, na yoke oh. I use mama Amaju ame-esi take wash all ur enemy eyes as I perm all dem Malcolm Tagbarha, Aijay, Babaduks. Elvis Ayomanor, Ogbeni Emonefe, Pablo Otoboh, Bemigho Bassey and all d single ladies of dis forum for Cargo Plane con meet u for obodo yibo. Oya begin dance skelewu b4 day go dark. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER
Posted on: Sun, 23 Mar 2014 13:44:34 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015