TYPES OF WIVES 1: SLAVE WIFE: She wan make de hubby treat am - TopicsExpress



          

TYPES OF WIVES 1: SLAVE WIFE: She wan make de hubby treat am like queen but she dey treat de hubby like slave. 2: GENERAL WIFE Dis one na Wife for every man. She de love and cares for boyfriends more than her Husband. She Like to dey give moni to her boifriends, dis one wey guys dey call suger mama. 3 BABY WIFE Irresponsible and childish and no fit make decisions on her own without asking her Mama or relatives; She too dey compare de husband to relatives or friends hubby and dey run to them everytime wahala dey. 4: VISITING WIFE: she no always dey dey house, she too dey travel all the time for work and dey leave her pikin wit Ekaite, if de Hubby no too strong hmmm.. Na anoda tori be dat o. . 5: CARING WIFE: Dis one dey Caring and loving. She dey Provide material and emotional needs and dey make time for de family. She dey guides de home spiritually. Very responsible and treats husband as partner and helper. 6: DRY WIFE Chai! Dis one dey too dull, she no even dey consider her Husband emotions and she no dey make de relationship enjoyable. Dis kyn one fit tire you shapaly, just dere. Even self some dey stingy atimes. 7: SPINSTER WIFE: she dey do her thinz herself, she no dey even tell her husband, she too dey hand out wit her female friends no even get time for her marriage life 8: QUESTIONAIRE WIFE: Dis one too dey ask questions, d one wey consign am or no consign am she go dey ask, she fit even dey ask some kind of questions wey de man google (brain box) no fit access.. 9: ACIDIC WIFE : She too dey boil like acid, too dey vex, dey hot temper, ogbono felifeli, she dey make de home uncomfortable for de man. 10: FREESTYLE WIFE: She is lively, caring, trustworthy, real but ha! She fit give you naught wahala wey you self no fit vex for am no mata wetin she do. She go do you strong fin, you go just look am, for na mind you go like say na nothing jare. 11: PANADOL WIFE: she too dey use de husband as problem solver, only love de hubby when she need something from him. 12: PARASITE WIFE: Too Lazy and only love de husband for de sake of money. She no even dey helep in house responsibilities. 13: NEPA WIFE: Off and on kynd of wife, today na jovial tomorw na dulling, today yes tomorrow No. De Man go just dey in state of confusion. 14: TESTING WIFE: She too dey test de man patience, to know wetin ihn fit do, na de time him do strong thing she go dey call am Wicked na na she test ihm patience. Na so ih take be o.. Make we yan, So Husbands and Guys, which kind of wife or girlfriend you dey with..
Posted on: Wed, 02 Oct 2013 19:07:20 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015