Telephone Conversation Between Ngige&Tinubu Leaked... Tinubu: - TopicsExpress



          

Telephone Conversation Between Ngige&Tinubu Leaked... Tinubu: Onwa weting happen now? Ngige: Good day Asiwaju Tinubu: Whats good about the day when eclipse happen for your dormot? BTW, wetin make you off your phone? Ngige: Sorry sir, I be wan call you now Tinubu: There is nothing to call me for, I hear wetin happen Ngige: But sir, hope still hope dey o Tinubu: Which kan hope be that? Ngige: The 65 units now? Tinubu: Your head correct at all? The total polling units na 4,608 and youthink say 65 go make you win? Abi u be witch? Ngige: Oga, na Plan A be that o Tinubu: Weting be Plan B? Ngige:Cancellat ion or we go court. But I wan make you activate theLagos/ Ibadan Liars make them start dey spread propaganda and dey invent stories quick quick. Tinubu: Ngige Ngige Ngige. How many times I call you? Ngige: Three times AsiwajuTinubu: Nothing go save you. I sent that short-devil called El-rufai to go rig the election. Instead make him keep e mouth shut, he announced am for Facebook/ Twitter. Na so SSS take know about am Ngige: Aha, abi wan report that short man to you sef Tinubu: No report anything. No be him make you lose. Nwoye wey campaign for just 2 weeks get votes pass you. I dey shame for you Ngige: No be like that o, Jega follow do am too Tinubu: Na lie! I told you say your people go reject you but you nobelieve. Dem reject you for 2003, 2006 & 2010. Why you think say them no go reject you again? Na same problem wey I get with Buhari weymake me no wan make e run in 2015 because Nigerians don reject am sotee I don lose count. Ngige: Make I talk true. Na Fashola make me lose this election Tinubu:For weting na? How my boy make you lose? Ngige: No be him deport my people? Tinubu:But, I be tell am make e beg now and he did. Na my boy make them reject you for 2010 too? Anyway, no be weting I call u for. I be businessman and you sabi how much I put for this election, N3.21 Bn, so I need am back in 2 weeks. I no be Chris Uba, so dont mess with me.(***line cuts***) Ngige:
Posted on: Thu, 21 Nov 2013 21:47:32 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015