There is dis particular restaurant wey i dey chop for wuse. E get - TopicsExpress



          

There is dis particular restaurant wey i dey chop for wuse. E get one oyibo wey dey always come chop there too. Any time dis oyibo chop finish him go shout "heey!", so i wonder wetin dey make am shout. I decide to chop wetin di oyibo dey always chop so maybe me self go shout too. When I reach d restaurant last week friday i order wetin di man dey chop dem tell me say na chicken and red wine, so i chop am. I surprise say i no shout. I even collect 2 xtra plate but i still no shout. Na then i just vex ask 4 my bill. The waiter tell me say one plate of chicken and red wine na #45,000, then d xtra plate na another #90,000 na then I come shout heyyyyyyy! Heyyyyyyy!! Heyyyyyy!!! Heiiiiiiiii... Till i reach house i still dey shout". Hahahahhaaah!.....
Posted on: Thu, 08 Aug 2013 15:09:33 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015