U use BlackBerry to oppress,now everybody has a Black Berry.You - TopicsExpress



          

U use BlackBerry to oppress,now everybody has a Black Berry.You used ur camry to Buga,now boys dey use Camry to do taxi. * Before u dey use ur plasma screen dey,swell.... now dem don dey use am watch ball for Canteen, * B4 u dey use ur ipad dey swag...now ipad,na heavy load to carry comot house, * B4 u go dey use brazillian hair dey form biggirl,secondary skul student don dey wear am throway, * B4 u dey go vacation 4 UK dey talk pass urself, boys don dey buy 1st class ticket dey enta london just to go watch a day concert come back next day BOTTOM LINE: no dey over do like say dat tin no go reach another person hand, All na vanity, e dey fade like Aba Jean..No 4get say tortoise car na big man motor b4 o..Notin wey come wey no get expiring date,even the life go expire....Humility na the best choice!!! Good day. TGIF
Posted on: Fri, 05 Jul 2013 14:05:56 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015