When I was a kid, we used to ask ourselves dis question, if yr mum - TopicsExpress



          

When I was a kid, we used to ask ourselves dis question, if yr mum nd yr wife are drowning in a river, who will u rescue first? nd then I would gladly answer, my wife nd the reasons were dat my mum is someone elses wife. But let us really face d fact. If u ask me dat same question again now, brotherly! I will rescue my mother first! Pointblank. The reasons are; 1. My mother is predictable but wife is liable to disappoint me! 2. No other woman can love nd appreciate you like mother! Its hard to acknowledge but it is d truth. 3. Mother can die for you to live if d need arises but wife will never chose to die in yr stead if d need arises. They will jump unto d next available flight once yr plane crashes. Tell them I said it. 4. I cant get another mother if I lost her but I can always marry another wife if I lost one. If u like vex say I talk am but na true. If na me die swear say u nor go marry another man. Afterall nor be me send u go where river dey. How u take fall put sef? Eyaa! Sorry eh. Abeg wait make I carry my mama comot first. 5. Monkey no fine but he mama like am. Abi nor be so? But if u nor fine, girl nor go like u talkless of become yr wife except say every every dey wi you. Da side kle. 6. If na Okreka na im my money reach I buy am for my mama, she nor go mind say na Okreka, she go still wear am still dey happy dey tell her friends say na Believe buy dis shirt for me o. She go still thank u still pray for you join am sef. Kai! Nothing like mama! But go buy Okreka give yr babe or wife first. Yr own don finish. Fear nor go even let u buy am talkless of give her. 7. If u and yr mama dey watch Van Vicker film, yr mama fit make comment say this boy fine oh but trust d kine mama wey I get. She must say na my pikin fine pass. But if na babe, una know every every na. Check her facebook friends list. Van vicker name dey there or she don even send request already. So u come dey tell me say make I rescue wetin leave my mama. why u nor go call road safety or marine police? Abeg comot from road make I see. Nobody can take d place of yr mother. Not yr wife, aunty or sister. Even my sister sef, I go first rescue my sister before I go rescue my wife bcos 1. If I visit my sister, na me get her kitchen for dat period. D kine sisters wey I get, dem too much. But some kine winch wife, if yr sister come yr house, she nor get right to enter kitchen go serve food chop. If she try am, even if yr wife no talk to her, later she go tell u say I dont like d idea of yr siblings opening my pot. Na yr papa buy d pot abi na him give u money take cook d food? But if na her own siblings dem fit do as dem like o. Which kine useless wife be dat. I swear if my wife jst behave like winch, I fit kill am. Bcos a nagging woman is detrimental to a mans psychological welfare. So in other to avoid stories dat touch, pack out if u cant treat my family d way u will treat yours. So d truth is dat, fine yr wife is yr wife but nothing like mama or sisters oh. Na dem go dey wit u personally if yr wife move in case of incasity.
Posted on: Thu, 07 Nov 2013 10:49:30 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015