one day two male boys go tif sack of orange, dem come go inside - TopicsExpress



          

one day two male boys go tif sack of orange, dem come go inside cemetery go share am, wen dem de go two orange fal 4 gate, but de boys no pick am b/cuz dey get enof 2 share, so dem come start to share am, one for me, one for u, one for me, one for u, one man wey drink come de stagger pass de cemetery gate, and come de hear one for me, one for u na him de man run go church go tell pastor say God and saten de cemetery de share dead body, two of dem come deside to go check, wen dem reach dere, dem come de hear onofor me, one for u, til dem share am finish, nai one of d boys say wat of dos two wey d for gate? pastor run troway bible de shout I never die oooooooooooo..................
Posted on: Fri, 23 Aug 2013 20:15:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015