1. Give me your number Respondent: what for? Rara, I wan eat ham - TopicsExpress



          

1. Give me your number Respondent: what for? Rara, I wan eat ham ni! Mtchewww! 2. You dey work for bank, u dey form, what for? On top 30k ? Rubbish! 3. You get Phd, u no let us breathe again, ur paper na visa to heaven? Vanity! 4. You go dubai, u con dey display U.S. ascent, who you dey deceive? Ur head nw! 5. You dey wear 5.5 inches shoe on top fashion, u wan turn mount everest? 6. Hausa man fit give u hin market free for speaking to him in his language, try yoruba, una go hate yourself. Who get money pas? No be hausa?(Aliko Dangote) mtcheww! 7. Warri boys go dress materials for you so tey u no fit no say na fake tin. Wetin? U wan build heaven?(Ndi igbo join) 8. U dey preach charity for church, una dey put password on top church wifi, I reserve moi c0mment! 9. U don collect ur salary, u still dey fight person make e give u bribe, na sound money u dey collect, no be curse. 10. U don use 4+ or more good years as leader, u no wan leave again, na your family house? Thief! No vex if I don vex U! Na correct yarn! Good afternoon pals!!
Posted on: Sat, 11 Oct 2014 11:05:15 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015