28th July 2014- Auchi Poly News. PLEASE READ AND SHARE I greet - TopicsExpress



          

28th July 2014- Auchi Poly News. PLEASE READ AND SHARE I greet all d Students &Aspirants for d house, how una celeberate d sallah and d weekend? , today news na, For dose my oga and madam dem, way neva buy d Post Jamb Form(ND), as Auchi Poly cut off mark na 150, but d dept cut off mark own diff , Also for the BSC PROGRAMME una stil get chingili time to buy am, as the CBT day start 31st of july. Computer Based Test(CBT) e no hard lyk dat, mak una try Go tru una Jamb Past Question PaPER, dose way da find d requirements way una go cari cum 4 d Exam. Two(2) passport photographs Jamb result slip Acknowledgment slip Bank Teller. Optional-Birth certificate n State of Origin, Exam date na frm July 31st go reach August 6th 2014. 31st July 2014, Sch of Applied science. 1st August 2014,Sch of Ict. 2nd August 2014, Sch of Engineering. 4th August 2014, Sch of Environmental, Art&design and dept of Accountancy. 5th August 2014, Sch of Biz, (dept of Banking&Finance,Marketing n Pub-admin). 6th August 2014: only4 Biz Admin. For my Students way day Auchi Poly, mak we no forget waytn kari us cum here.. SCHOOL N CHURCH/MOSQUE N SMALL FLEXING. Mak we put more seriousness 4 we book, bkus 2nd semesta na GP SLICER. Alot of events 4 d semesta, so mak we no2 Flex to much, for dose way get Low/High GP, abeg mak una buckle up, una fit mak am, mak una no use una past tak condemn d future... Also mak una no 4get to day pray n go Church/Mosque, sak of say na we b d Leader of Today n D future. I cum hear say most Students no day call their parent n Love ones, abeg mak una day find time day call them, if no b 4dem, we 4 no day wr we day. B una Neighbours keepa, God lovs a Cheerful given. If u get anytin way day Borda u 4mind, weda na Financial, Relationship, Flexing, Reading/Understanding Problem, mak una no 4get to call/text Joe 4 08101006164. I salute our Eloquent Mama, Madam Rector,DEAN,HOD Academic Staff and Non- Academic Staff, Fellow Students/Aspirants, Especially Fazal Security, mak una keep on doin d gud work #Wap_Junior day Say, una go Live To see una Greatness. Una friends fit need am, #Share and RBC Na hear we go reach for today, una bye bye,mak i find way Man go Chop.
Posted on: Mon, 28 Jul 2014 07:27:24 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015