99.5 WAZOBIA FM: 9JA HOW UNA SEE AM: - Presido Goodluck Jonathan - TopicsExpress



          

99.5 WAZOBIA FM: 9JA HOW UNA SEE AM: - Presido Goodluck Jonathan don say all those people wey dey say Naija go dabaru by 2015 dem go shame when that time reach. President Jonathan dey talk this one wen some Muslim people wey na Vice Presido Namadi Sabo lead to go visit President Jonathan as dem end the Ramadan fasting. President Jonathan say instead of him to listen to this bad bele talk wey dey come from some few Naija people, him go focus on how to use the different languages, religions and traditions of Naija people to make Niaja great. My question now be say, e dey right for some of we country people to dey talk say Naija go dabaru by 2015? If your answer na yes or no, abeg give your reasons. LADYG (@ladygdgenius)
Posted on: Fri, 09 Aug 2013 14:19:52 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015