99.5 WAZOBIA FM ABUJA: Tori For Town: Anti-Robbery police wey dey - TopicsExpress



          

99.5 WAZOBIA FM ABUJA: Tori For Town: Anti-Robbery police wey dey Oko-Oba division don gbab one 32years old man, Sannu Umaru wey specialize to dey thief from churches wey dey around Oko-Oba area of Lagos State. Nah for inside weekend Umaru wey be pikin of one retired army personnel bin enta police hand as im bin wan go thief one church piano wey worth reach Five Hundred Thousand Naira (N500,000), as anoda instrument inside the church bin fall make noise for ground naim im bin dey try run away before the vigilante people for the area bin gbab am. Wen police bin torchlight Umaru, im talk say nah becos of the kain frustration wey im dey face after im papa death naim do wey im bin decide to dey thief wit gentleman style from churches, sake of say security nor too tight for dere & say im bin nor get mind to carry gun or trowey person blood… Hmmm!!! Bigmo (@bigmoNaija) & Yaksman dey ask which kain thiefery be gentleman style o? #UnaWakeUpShow #ToriForTown #WonderfulWednesday Twitter: @Wazobia_FM Tel: 094-600-995 wazobiafm
Posted on: Wed, 03 Jul 2013 05:23:25 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015