99.5WAZOBIA FM:NAIJA HOW UNA SEE AM:- Nigerian Electricity - TopicsExpress



          

99.5WAZOBIA FM:NAIJA HOW UNA SEE AM:- Nigerian Electricity Regulatory Commission(NERC) don advise piple wey no dey happy and dey even complain, say make dem go do case against the new money wey dem don add for electricity service charge (Light Bill) NERC Chairmo, Sam Amadi, don ginger different consumers joinbodi and Civil Society Group make dem sef come involve demself for dis light business and work for the commission. Dr Amadi say the business rules of NERC dey allow anybody wey no dey happy make e file case and complain so that dem go change wetin dey on-board. Now I dey ask, as a Naija Pesin which one you go prefer, shey make dem increase the light bill make light dey stable abi make dem leave the bill d way e dey before and light waka no go dey stable. And you agree with Oga Amadi ontop dis waka? Give us your reasons. LadyG and Oche D’King dey in da haus….
Posted on: Tue, 16 Jul 2013 14:19:09 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015