ASUU/FG STALEMATE MY NAIJA HAPPY PIPO UNA GUD MONI O, HOW UNA BODY - TopicsExpress



          

ASUU/FG STALEMATE MY NAIJA HAPPY PIPO UNA GUD MONI O, HOW UNA BODY WEN UNA TAKE SLEEP 4 NITE? WE SURE SAY E DEY KAMKPE, ABEG MAKE UNA TANK GOD WEN MAKE AM SO. NA ME UNA CONTRI BRODA, SULEMAN ODOMA EM OUR TADAY TORI STIL SMALL SHA, NA DIS ASUU STRIKE WEN DON DABARU OUR UNIVERSITIES NA IM WE WAN TALK OF TODAY. EM NA D REAL MATA WEN COM DEY HOLD D STRIKE NA IM WE WAN LET OUR PIPO KNOW TODAY. EMM, ASUU BEE TEL GOVMENT SAY NA NAIRA WEN BE BILION BILION WEN RICH NA IM DEM WANT TO TAKE GO BAK TO CLASSROOM. DEM COME SAY 4 INSIDE DIS BILION BILION SO, SOME BILION NA TO DO BETA BETA TINS 4 WE SHUL WEN GO MAKE LEARNIN AND TEACHIN DEY GO WEL WEL, DEM COM SAY D ODA BILION 4 INSIDE NA 4 PAY DEM 4 SOM ALAWI WEN GOVMENT PROMIS DEM 4 2009 WEN OUR OGA TODAY BE NUMBA 2 MAN 4 NAIJA. EM, GOVMENT COM FEST DO HUN-HUN-HUN, AFTA DAT DEM GREE SAY D 100 BILION DON DEY GROUND AND DEM COM SAY NA 30 BILION DEY GO FIT PUT 4 GROUND MAKE ASUU GO BAK TO WORK, DIS ONE COME BUST ASUU HEAD, DEM COME VEX COMOT 4 MEETING WIT GOVMENT SAY NA WAYO WAYO GOVMENT WAN DO DEM, SAY NA SO GOVMENT FEST TAKE TEL DEM SAY MAKE DEM GO WORK 4 2009 SAY DEM GO DO EVRY TIN WEN DEM WANT AND TODAY DEM NEVA DO AM. 4 DIS ONE SO, ASUU COME TALK SAY GOVMENT NO GO ONLY PUT ALL D MONEY 4 GROUND, BUT DEM GO SHARE D MONEY 4 DEM B4 DEM GO GO BAK TO WORK, DEM TALK AM REACH SAY DEM NO GO ENTA ANY MEETING WIT GOVMENT AGAIN 4 DIS MATA, SAY D BILION WEN DEM ASK NA 500 BILION SAY NO BE D ONE WEN GOVMENT DEY TALK SO, DEM COM SAY NA WEN DEM, ASUU DON SEE MESSAGE FROM THEIR BANK SAY GOVMENT DON PAY D MONI WEN DEM ASK NA IM DEM GO COM GO BAK TO WORK. DIS NA D BIG BONE WEN COM HANG 4 GOVMENT NECK, E NO LET DEM SWALOW, E NO LET DEM VOMIT. GOVMENT WAN MAKE FEAR CATCH ASUU, DEM COM SAY NA D LAW OF “IF U NO WORK DEM NO GO PAY U” NA IM DEM WAN COM PUT ASUU. EMM WE BE TINK SAY ASUU GO FEAR, WE COM HEAR YESTADAY WEN ASUU SAY MAKE WE NO MIND GOVMENT SAT DAT ONE WEN DEM TALK NO GO HOLD WATER. MY PIPO FEAR COM CACH US O. ANODA KOKO WEN DEY SHELE BE SAY MY FREND TEL ME SAY GOVMENT DON STIL PAY ASUU 4 DIS MONTH OF AUGUST WEN DEY END SO. GOVMENT DIS MORNIN DON TALK SAY DEM DON SCATA ALL D TALK WIT ASUU, SAY OPPOSITION PARTY DON PUT HAND 4 ASUU MATA, SAY DEM WANT MAKE NAIJA PIPO DEY SEE SAY DIS GOVMENT BAD. EMM AS D KATAKATA COM DEY SO, I 4 JOIN MANY GUD PIPO 4 NAIJA BEG GOVMENT MAKE DEM SETUL WIT ASUU MAKE DEM STOP DIS NO WORK WEN DEM DEY FOR D TIME WEN DON REACH 58 DAYS TODAY. DIS NA HOW SOME DIFREN CONTRY DEM DEY PUT MONEY FROM THEIR BUDGET FOR SKUL MATA FOR AFRICA; GHANA .............................................................31% OF THEIR NAATIONAL BUDGET COTE D’IVOIRE ................................................30% UGANDA............................................................27% SOUTH AFRICA.................................................25.8% (POOR) SWAZILAND.........................................24.6% BOTSWANA.......................................................19% (EVEN PIPO WEN DEY SMOKE) MOROCO..........17.7% EVEN LESOTHO..................................................17% TUNISIA.............................................................17% OUR OWN GIDIGBA NAIJA.................................8.43% (SINGLE DIGIT) NA ASUU BRANCH 4 UNILAG BRING DIS MESSAGE! ABEG MAKE WE CHANGE JOIN HAND TOGEDA MAKE NAIJA 4 BETA. IF U NO GREE ABEG MAKE U NO VEX 4 ME, NO COS ME, NO BIT ME, NO SWEH 4 ME, MAKE U TOK UR OWN, AS U DEY TOK UR OWN, MAKE U TEL US D KOKO WEN DEY INSIDE O. MAKE WE CONTINU TO DEY DO D DIFREN DIFREN GUD TINS WEN WE DEY DO TO MAKE WE NAIJA BETA PASS AS E BE SO. EM MY PIPO IF U BE MY FREND 4 FACEBOOK, MAKE U WAIT WE GO SOON START TO DEY SEND D VIDEO OF DIS PIDGIN “CHANGE, 4 BETA NAIJA” MESSAGE TO U, BUT IF U GO LIKE D VIDEO AND U NEVA BE MY FREND MAKE U STRECH UR HAND COME (send request) MAKE WE BE FREND SO DAT U GO FIT DEY GET AM TU . MAKE SURE SAY U SEND UR OWN QUIK BCOS WE OGA WAN KNOW HOW MANY PIPO WE GO DEY SEND AM FOR O, D VIDEO MY PIPO E GO BE AHUF, NA FREEEE. UNA WEL DONE MAKE UNA DEY WEL O. GOD GO BLESS NAIJA MAKE E 4 BETA 4 US ALL!
Posted on: Tue, 27 Aug 2013 05:21:53 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015