...ASUU STRIKE ADVERT!!! Asuu Indomie Advert!!!! Asuu do go - TopicsExpress



          

...ASUU STRIKE ADVERT!!! Asuu Indomie Advert!!!! Asuu do go ooo.. E do gud. Asuu wey give us strike... E do gud. Wey make us stay @home... E do gud. Dey chop mama food tire.. E do gud. Sote I forget my Matrick number..E do gud Dis strike dey sweet well well.. E do gud Final year students don forget say dem still be students.. E do gud. Dem dey fink say dem dey wait for service.. E do gud.. Sum pple don join yahoo.. E do gud. Sum don dey do ashewo.. E do gud. Sum guys don dey do gateman even medical students ... E do gud. Sum gurls don dey do Ekaite.. E do gud.. Abeg who know wen strike go end.. E do gud. Even pastors no know, E do gud. E come like google go know, E go gud. No strike go be like Asuu, no holiday go long pass dis 1. Our Class gurls don too get belle.. E do gud Our gurls don marry finish .. E do gud Me don tire for house o.. Bt E do gud.. Me don dey old for house... E do gud. House don become our oFfice.. E do gud.. Joblessness plenty.. E do gud.. Me don dey sing nonsense.. E do gud. Wey pple dey listen to nonsense.. E do gud. Me n u get sense.. E do gud. U dey dance as I dey sing.. E do gud. Who strike pass Asuu.. E do good.. Oya dey thief am dey go I see u nothing do you.. E do gud.. Na so o.. Asuu don show plenti pple strong thing.. Oya dey SHARE am dey go.. E do gud..
Posted on: Thu, 14 Nov 2013 19:52:43 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015