ASUU STRIKE ADVERTISEMENT!!!Yes O! E don happen again o.Chukwudi - TopicsExpress



          

ASUU STRIKE ADVERTISEMENT!!!Yes O! E don happen again o.Chukwudi Films in associationwith Chukwuemeka Picturespresents anoda ogbonge movie ASUU STRIKE 2013.Dis one na movie wey pass movie ooooo. Dem no dey tell person dis 1 oooo, u must to watch am by ursef. Come hear the true story behind the whole ASUU Strikeooooo-who start am, why dem start am,who supose end amand who no gree end am ooooooo!U go c all for dis movie.Money don scatter our country ooooo, dis 1 dey ask 4 money, dat 1 say no money.....ewoOoooo Chai com c as university student dey suffer,c as crime dey increase. Girls dey born lk fowl, yahoo men dey press die...See Blood! Blood!! Blood!!! rich man no even worry.Leaders no even send. Wetin poor man go do.Kai! ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . .Suspense full am, intrigue, romance, swagger, ginger... Dat will kip u glued to d edge of ur seat .U go laff,u go cry and u go reason sef.ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . .Grab ur copy now! Starring: Kanayo. O. Kanayo asGoodluck JonathanPete Edochie as Nassir faggiePatience Ozokwor as Ngozi Okonjo-Iweala, EuchariaAnunobi as Ruqayyat Ahmed Rufai andOlu Jacobs as Gabriel suswan.. Jim iyke as yahoo boy, sacca na poor man oooo. ASUU STRIKE 2013!Grab ur copy now..!
Posted on: Sat, 23 Nov 2013 11:12:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015