ASUU STRIKE FILM ADVERT!! Hehehe!! Yes O! E don happen again O! - TopicsExpress



          

ASUU STRIKE FILM ADVERT!! Hehehe!! Yes O! E don happen again O! Chukwudi Films in association with Chukwuemeka Pictures present anoda ogbonge movie ASUU STRIKE 2013. Dis one na movie wey pass movie o! Dem no dey tell person dis one o! U must to watch am by urself & for urself. Come hear the true story behind the whole ASUU Strike. Who start am? why dem start am? who suppose end am? and who no gree end am? U go see all for dis movie. Money don scatter our country o! Dis one dey ask 4 money, dat one say no money...ewoOooo o! Chai! Come see as Universities students dey suffer, see as crimes don dey increase o! Young girls dey born like fowls, yahoo boys dey press control enter ooo! see as lecturers kukuma don turn home teachers & some dey roger kabukabu with dem moto... Parents dey cry say their children don finish food for house o!. Ew... ew...ew...see this mama, she say na 4 mudu of rice she dey chop per month but now wey her pikin dey house, nah 1 bag per month ooo...! chai! See Blood! See Blood!!See Blood ooh!!! Students no gree oooh. Rich men no dey worry. Leaders no even send. Ewooooooo! Wetin poor man go do? Kai! ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!! Full of Suspense, intrigues, romance, swagger, ginger...wey go keep u gum to d corner of ur chair. U go laff, u go cry and u go reason tire sef. ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . . Starring: Kanayo .O. Kanayo as Goodluck Jonathan Pete Edochie as Nassir faggie Patience Ozokwor as Ngozi Okonjo- Iweala Eucharia Anunobi as Prof Ruqayyat Jide Kosoko as Gabriel Suswan Olu Jacobs as Prof Julius Okojie Jim Iyke as Yahoo boy Saka as poor man Marketed and distributed nation-wide by chiemelie & Sons Ltd, 7 pound road Aba! ASUU STRIKE 2013! Grab ur copy now !!!
Posted on: Wed, 04 Dec 2013 08:10:06 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015