AUGUST 17TH, 2014. AUCHI POLY NEWS. Great Gbogbo, Great Gbagba, - TopicsExpress



          

AUGUST 17TH, 2014. AUCHI POLY NEWS. Great Gbogbo, Great Gbagba, Great Polytes, DORO MORNING. Thank God for a brand new day. som students Fb/Bbm status. 1. WORLD NEWS: ATM wan day charge N65 as from September 1st, 2014. for any withdraw way u make. Emefiele, na wetin u find come CBN be dis? To spoil wetin we been dey enjoy? EBOLA VIRUS don day Spread lyk Fire, mak una quick day enta house mak e no burn una. 2. SCAM ALERT: A MUST READ TO ALL ND/HND/BSC ASPIRANTS: i don beg una tire soté una no wan listen2me, mak una no send money 2people way una knw no, un2 Admission mata, but una no wan hear, bkus una day eagar2 enta skul. Education na 4all, una rememba Say wen una day do una ONLINE 4 POST UTME, som People way assist una day Save una BIaO DATA 4deir COMPUTER???, Latest Research way i do, 419(fraudsters) wan tak Fraud aspirants Money, Anybody way call you, tell you say him/her day wif ur Credentials nw, say him/her day work4 MIS or ADMISSION OFFICE , say him/her wan giv u ADMISSION, mk u no believe d person. Na God day gv Admission, Bkus som guys nw adays, day use deir babe, wan tak mak Money, una no say wen guys hear WOMAN voice dem don fall bdat. I go day Post More HINTs so dat una no go fall Maga, enuf is a word to enlighten d wise. Mak una day careful. Abeg #Share to Others, way need am pass you. Mak una Warn Philipa O. Idogho, d ones way day facebook. 3. SCHOOL NEWS: I don Customize d Lay out, way i go take day give una Gbasky News, for easy undestanding, how una see am? RATE IT. Yestaday Kparakpor na BOMB!!!, live band and all. At last!!! NIFES don paint their Church. Today 17th August, na the thanksgiving service sunday for Poly-week, Venue na Hostel Cafe B tym na 8am. 4. ENTERTAINMENT: NIFES Music night, way near Campus1 gate na 21st August 2014 tym na 2pm. Na must cum. Mak u cum hear different melodious voice of Gbasky polytes Choirs. I get property b4, no b Talk. 5. ADVERT: Nokia C5, Nokia X2 dual sim for sale call 08101006164 6. SCHOOL INFO: *SUG NEWS: SUG Election na this Week. *AUCHI POLY EXAM: Regular Exam-School of Art&Design na next 2weeks, while the rest SCHOOL na next 3weeks. *SES Exam-na october time. *AUCHI POLY FORM: HND form neva cum out we go inform una wen due. SPAT form na September period, e go tak show face. No fall magg *AUCHI POLY ADMISSION LIST: ND/Bsc CBT result neva cum, mak una day patience, wen e cum out, i go let una knw. No fall maga. 7. SPECIAL SHOUT OUT: Aleghe Nicholas EugeneOsi: day wish him girlfriend GLORIA AJANAKU happy sunday and success 4 her upcoming exams, also him sister(Nicholas Peace) n him cousin(Usman Faruk) success 4 their exams 2. 8. BIRTHDAY WISHES: Pending Request. 9. HELP LINE: 09094408154 , 08101006164 10. COMMENTARY: Abeg mak una they try they comment and share our post. Una happy Sunday. 11. NEWS CIRCULATION: our News they reach 80,000 Students/Aspirants. 12. CONCLUSION: This na the news way we get for the day, we don cum back with alot of branded style. if u get anytin to add lyk news,advert,info,entatainment,birth wishes, abeg fil free to use d comment box or inbox #Wapjunior. For our Tomorrow publication. thanx.
Posted on: Sun, 17 Aug 2014 07:18:54 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015